Sammie Okposo: Nigeria gospel artiste die, wetin we know

Nigerian gospel artist Sammie Okposo don die, one of im management tok.

Oga Sammie Okposo die around 4am on Friday 25 November 2022, im management for di United Kingdom confam.

E never dey clear wetin be di cause of di death but dem say Oga Okposo die for Nigeria.

Im management say dem go release statement to give details about di death.

Di late Sammi Okposo dey popular for di kontri as im don sing plenti songs wey plenti pipo enjoy.

One of im songs wey dey popular be Wellu-Wellu wey im release for year year 2000.

Sammie Okposo na household name for di Nigerian Gospel music section, im also get plenti award to im credit.

Early dis year Sammie Okposo bin do one open apology for im wife Ozioma for wetin e describe as intimacy wit anoda woman.

For di confession wey im put for im social media handle, Oga Okposo bin say im bin dey ‘intimately involved’ wit anoda lady.

Many Nigerians commend di move as great one.

Ozioma Sammie Okposo and di controversy

Nigerian gospel artiste, Sammie Okposo openly apologise to im wife Ozioma say e dey intimate wit anoda woman during im recent trip to America for di ending of 2021.

Oga Sammie wey post di open confession for im social media page say im bin dey involved inside intimate relationship wit a lady wen e travel abroad.

Di artiste wey dey popular for im Wellu-Wellu song also publicly tell im wife, say im dey very sorry and e regret im actions as e know say im don cause her plenty pains.

Nigerian gospel artist explain why e collect money wey native doctor spray am

‘We don wait for too long’- Fans react afta Mercy Aigbe show off ‘boo’ on social media

“On my recent trip go USA (late 2021), I dey intimately involved wit a lady, I know say dis one no dey appropriate as a married man and a minister of di gospel. I dey ashamed and regret my actions as e don cause plenty pain to my dear wife, Ozioma, my family and I.

“To my wife, Ozioma, I am sincerely sorry say I put you through dis shameful and embarrassing situation. I break your trust and disappoint you.

Your forgiveness of my moral failure and poor judgement dey important to me. I pray I go eventually dey able to build back di trust and confidence every single day forth.” E tok.

E also apologise to im fans and oda ministers of di gospel for im behaviour and im moral failure.

“I wan take dis moment and apologise to all fathers and mothers of di Faith and ministers of di Gospel for my behaviour and moral failure.

To all di pipo wey don be part of my ministry, follow my ministry or know me personally, I dey truly sorry for disappointing you. I regret any pain or disappointment wey dis news of my moral failure and poor judgement fit don cause una and I dey truly sorry for disappointing you.

I humbly ask make you continue to pray for me.”

Oga Sammie add say im dey suspend imsef from all ministry work until e get full restoration.

Sammie Okposo biography

Sammie Okposo be multiple award winning Nigerian gospel artiste, music and video producer.

Dem born am for 20 May 1971 and die for 25 November 2022.

E come from Delta state, South-South Nigeria.

According to im Twitter profile, e be United Nations Youth Ambassador.

One online media, Believers Portal say oga Sammie start im music career for 1995 wen e join di Nigerian movie industry as a sound track producer before e later enta into full time music production.

For 2000, e carry African music enta anoda level wen e release im first album, Unconditional Love. Di hit track of di album, “Welu Welu”, gain plenty local and international popularity.

For 2004, American ambassador to Nigeria bin invite Okposo to perform for di Martin Luther King Day and July 4th Independence day Celebration.

E bin marry im wife Ozioma for July 2010.

Awards wey Sammie Okposo don win

  • 1994Fame Music Awards Most Promising Male Artiste
  • 1997The Movie Awards, NigeriaBest Sound Track
  • 1998Best Sound Track
  • 1999Best Sound Track
  • 2000Best Sound Track
  • 2001Amen Awards, Nigeria Best Gospel Artiste
  • 2002Power of Music and Praise AwardsBest contemporary gospel Artiste
  • Gospel Artiste of di year
  • 2003Kora Awards, South AfricaBest Male Gospel Artiste in Africa[15][16]Nominated
  • 2005Amen AwardsBest Male contemporary gospel Artiste in Nigeria
  • CNA AwardsBest remix Album
  • Teen choice AwardsArtist of the year
  • 2006Afro Hollywood Awards UKBest Gospel Artiste in English
  • Nigeria Movie AwardsGospel Artist of diiyear
  • Best Sound and Music Score [Amazing Grace]
  • Kora Awards, South AfricaBest Male Gospel Artist in African
  • 2007Nigeria Entertainment Awards, New YorkGospel artist of di year
  • 2008Nigerian Music Video AwardsBest Gospel Video
  • Nigerian Music AwardsBest contemporary Gospel Artiste
  • 2010God zone awardExcellence in Entertainment
  • 2011Nigerian Music Video AwardsBest music video producer
  • 2012Inside Out media awardsPositive impact awards
  • Pastor Bimbo Odukoya foundation awardsBest male Christian artiste
  • African Gospel Music Awards U.KTrail blazer award
  • Real Soccerfest and CANGrass root ambassador of di year
  • 2013Crystal Awards, NigeriaAlbum of di year (Di Statement)
  • Artiste of the year
  • Nigeria Entertainment Awards, New York CityBest Gospel ArtistWin
  • Gospel Music Awards, NigeriaBest Indigenous/Traditional Song Nigeria
  • Album of the year
  • Nigeria Gospel Music Awards, NigeriaArtiste of di year
  • 2014Africa Gospel Music Awards (UK)Music Video of di Year (Who Tell You Say)
  • SABC Crown Gospel Music Awards (SA)Best of Africa Gospel[19]
  • NMVA Nigerian Music Video AwardsBest Gospel Music Video (Who Tell You Say)
  • 2015African Entertainment Legend AwardsGospel Artiste of the year
  • The Beatz AwardsBest Music Producer
  • Best Afro High life Artiste
  • Trumpet gospel music awards South AfricaBest worship song
  • 2016Trumpet gospel music awards South AfricaBest worship song
  • Atlanta Georgia USA-Trail Blaizer AwardBest of African gospel awards
  • 2017African Gospel Music and Media Awards,UK (AGMMA Awards)Male Artiste of di year