EFCC Chairman Abdulrasheed Bawa go go prison?

As di news comot say one Federal High court for Abuja convict di oga of di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC), Abdulrasheed Bawa for contempt, plenti reactions full ground.

Di court direct make dem lock Oga Bawa for di Kuje correctional facility, for di Nigerian capital, Abuja. Pending wen dem obey one court order wey say make di commission return one range rover and di sum of of N40 million naira.

EFCC say dem don return di vehicle but di moni still dey dia hand.

Justice Chizoba Oji wey give di judgement also direct di Inspector General of Police, Usman Baba to make sure say im execute di order of di court sharp sharp.

‘We neva see any document on di order’

Im say oda reason join for di mata like Bawa disobedience and continous disobedience wey im no gree stop.

Meanwhile, di Police tok tok pesin Muyiwa Adejobi tok say dem no dey aware of di order.

E tell BBC News Pidgin dis one on Wednesday, 9, November, one day afta di fresh court order.

“If court give judgement yesterday, na dat same dia dem go release di documents?” Na so di spokesperson tok.

E say dem (di Police) neva see any document.

Wetin Bawa and EFCC tok

EFCC oga Abdulrasheed Bawa say dem go allow di law to take im natural course on di mata.

42-year-old Bawa tell tori pipo Channels TV say dem don appeal di order.

Later for statement EFCC tok tok pesin say dem receive di judgement as surprise as dem get good relationship wit di judiciary and dey always appear for court.

EFCC say Oga Bawa no be dia chairman wen court give di initial order for 2018 (to return di items), but as im get knowledge of di ruling e begin act on am.

For statement, dem reveal say dem don already release di car to di applicant since June 2022.

Wetin law say suppose happun

Lady justice

Getty Images

Onwuka Egwu wey be Nigerian based lawyer say di right tin for di EFCC to do na to first obey di first court order immediately before dem begin file appeal.

“Dem suppose return di Range Rover and di 40 million to di applicant as di court order, den dem fit appeal, to appeal na dia right” na so di lawyer tok.

E add say “e go be an indictment on di inspector general of police if im no obey di order to remand Bawa for prison”.

Oga Egwu sight di case of Asuu lecturers wey court order to go back to school, dem rush go appeal first, but di appeal court tell dem to first obey di court order before appealing.

“So EFCC suppose obey court order first before dem go begin file appeal. Dis na order wey dem give since 2018, you no obey and you no file any appeal till now”?.

“Wen court give order, di law say you suppose comply, if you no obey, you dey at fault”.

Wetin lead to di current mata for di EFCC oga

Oga of di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) Abdulrasheed Bawa don tok say im agency (EFCC) don appeal di judgement wey di Federal Capital Territory (FCT) High Court give earlier, wey convict am for contempt of court.

Di judgement also say make Abdulrasheed Bawa go relax for Kuje prison sake of say im agency fail to comply with one court order wey happun before.

Di EFCC oga bin tok as in dey answer questions from tori pipo afta im budget defence session with lawmakers for di House of Representatives today 8 November 2022.

Im say im organisation go make sure say di law, di provisions take im full course.

Oga Bawa still tell tori pipo say dem don recover plenti proceeds from crime dis year.

“We don get quite a lot of proceeds from crime and di provisions of Coker tok say make each relevant agency open confiscated and forfeiture accounts, we don open am and we dey remit evritin wey belong to Federal Goment into dat account.

We dey also pay victims of crime from dat recovery account”.

EFCC oga also add say di Commisssion need more more for di new EFCC Academy wey go help dem dey ahead of di criminals through training nad re-training.

“We dey build a brand new EFCC Academy and we need funding for am, last year dem allocat Three billion while dis year nothing nothing, na why we dey beg members say we need dis new EFCC Academy sake of say we need to learn, as fighters of crime we need to dey ahead of dis criminals, di only way to do am na to rain and re-train, I believe say di National assembly go hear our request” oga Bawa tok

Why court send am to prison

Local media report say Federal Capital Territory (FCT) High Court bin order Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) chairman Abdulrasheed Bawa to Kuje Prison for Abuja.

Court say di EFCC oga commit contempt of court sake of say di commission no comply wit one order wey court give earlier.

For di ruling wey happun Tuesday 8 November, 2022 Justice Chizoba Oji tok say di oga of EFCC dey in contempt of di order of di court wey bin happun four years ago.

On 21 November, 2018 court bin direct EFCC to return one applicant Range Rover (super charge) and di sum of N40 million naira

Tori be say di judge reject di arguments wey EFCC lawyer Francis Jirbo bring for front to justify di action of im client.

Local media dey report say na on October 28, wey Air Vice Marshal Rufus Adeniyi Ojuawo file motion on notice.

Marshal Rufus Adeniyi na former Director of Operations for Nigerian Air Force (NAF).

For di motion, di former Director of Operations complain say EFCC no gree comply with di order, for di release of im seized property, wey court give for 21 November, 2018.

Who be AbdulRasheed Bawa

AbdulRasheed Bawa na trained EFCC investigator wey get orishirishi experience for di investigation of advance free fraud mata, official corruption, bank fraud, money laundering, plus oda kains of economic crimes.

Im na di youngest EFCC oga since dem create di commission for 2003 and one of di first cadet officers EFCC bin get for 2005.

Part of im achievement be say im be di chief investigator for di alleged multi-billion naira fraud case against former Minister of Petroleum Resources, Diezani Alison-Madueke.

E come from Kebbi state and dem born am for 1980.

Di EFCC oga na Certified Fraud Examiner (CFE), Certified Anti-Money Laundering Specialist (CAMS) wey don collect training for United States Federal Bureau of Investigation (FBI), United States Financial Crime Enforcement Network (FINCEN).