Motara video: “I deserve all di insults, I go do evritin for dis life to right my wrong”

Motara wit di child beggar

MOtara/twitter

Nigerian social media influencer Motara don express deep regret for wetin she do inside one viral video wey she bin mock one small girl wey dey beg her moni.

Inside interview wit BBC Pidgin, Motara tok say since dat night wey di video drop, she don dey cry and she neva fit sleep.

“I just wan apologize because evritin just dey happen fast fast. I no even know what else to do. I don go look for di girl. I go on Monday, Tuesday, Wednesday and I go still go there today.

“As I dey go there, I dey carry sometin go evriday and if I reach there, I go carry all those tins – packs of drinks, evritin share am for di pipo wey dey there but dem dey tell me say dem don carry di girl go Arewa”, she tok.

Di incident wey happen for Ketu, Lagos bin make pipo blood boil as di video show Motara wey dey inside her moto, dey use mineral wey she dey drink to do longer throat for one small girl wey dey beg her moni inside traffic.

Motara laugh di girl join as di small girl bin dey run afta her moto.

Di oda pipo wey dey beg moni for di area no wan gree allow Motara see di girl sake of say worry about her safety. According to Motara, di small girl na Almajiri.

Di 25-year-old Microbiology graduate of Ibadan Polytechnic explain more give BBC Pidgin say, “Na wen I reach there I come realize how terrible wetin I do be. I bin meet other mothers wey dey beg there and dem really insult me say who go do dis kain tin. I just dey beg dem make dem understand say I no mean am dat way.

“Me sef na from ground I stand up and I be Christian. How much I don get? Wetin I don make for dis life wey I go dey mock somebody.

“I no be dat kain pesin but I no say dem suppose insult me because wetin I do dey wrong. I no fit try justify wetin I do inside dat video. If you see me now, I no fit comot witout putting on glasses because my eyes don swell up.”

Earlier today, November 26, social media giant Twitter bin suspend her account for violation of dia rules.

Di video bin make pipo vex no be small, sotay dem begin report di influencer accounts say she go against Twitter and Instagram policies.

E dey likely say di policies wey Motara go against na ‘Abuse and Harassment’ for Twitter or ‘Respect for oda members of di community’ for Instagram wey dey against any kain behaviour wey dey downgrade anoda human being.

As e be so, di mata don attract global attention as French pipo for Twitter don also chook mouth dey express dia anger.

Apart from her suspended social media accounts wey get hundreds of thousands of followers, Motara bin also lose her endorsement deal wit di owners of di drink, Brothers Keepers wey she use yeye di small girl.

Di Ibadan-based influencer later issue apology wey she tell BBC say she no delete and also claim say she bin dash di child beggar moni afta she mock her.