Flamingos fail to reach Fifa U-17 World Cup final afta penalty shootout defeat to Colombia

Flamingos fail to reach Fifa U-17 World Cup final afta penalty shootout defeat to Colombia

Getty Images

Colombia don qualify for di final of di Fifa U-17 World Cup competition afta beating Nigeria 5-6 on penalties.

Dem go play di winner of di second semi final match between Germany and Spain on Wednesday.

Di game bin start slowly wit Nigeria taking charge in di first 15 minutes – but e no tay wey dem lose dat possession to di Colombians.

Colombia dominate di game for most of di first half and the entire second half.

‘Sudden death’

Nigeria bin tink say dia pattern against USA for Quarter final fit work against Colombia.

Di Flamingos bin use penalty qualify wen dem beat USA 3-4

Nigeria change dia goalkepper – Jiwuaku enta for Omilana. dem also bring in Offiong to substitute Bello for di last minute.

All dat strategy no work. Jiwuaku bin prove why dem bring am in wen she save Munoz penalty kick but her heroic save no dey enough to carry her team enta final.

Edafe wey bin get di last kick to give Nigeria victory fail to score. Her kick hit di bar.

As di penalty enta sudden death, Nigerian defender shoot her kick go wide wey give Colombia a deserved victory.

Penalty Kick: Nigeria 5-6 Colombia

Nigeria vs Colombia for FIFA U-17 Women's World Cup semifinal

Getty Images

Rodriguez score for Colombia

Offiong score for Nigeria

Perlaza score for colombia

Etim score for Nigeria

Munoz miss. Jiwaku save am

Usani score for Nigeria

Espitaleta score for Colombia

Afolabi score for Nigeria

Caicedo score for Colombia

Edafe miss. Ball hit bar

Ortegon score for Colombia

Oyinlola score for Nigeria

Hernandez score for Colombia

Forlorunsho miss. Agudelo catch am

FULL TIME: Nigeria 0-0 Colombia

Second Half: Nigeria 0-0 Colombia

90+5mins: Corner for Nigeria. Usani square di ball in but Colombia defend am comot.

90+3mins: Wetin Nigeria dey do now na to defend till di end of di game

90+1mins: SUBSTITUTION. Nigeria change dia goalkepper Jiwuaku enta for Omilana. Wit belief say di match go enta penalty

Offiong also enta for Bello.

90mins: Corner for Nigeria. Simple save for Agudelo.

88mins: E be like say Nigeria wan escape dis pressure from Colombia for di regulation time.

86mins: Anoda miss by Caicedo inside Nigeria 18. Di ref later call for foul against Folorunsho

85mins: Foul against Afolabi. Na Rodriguez dey take di free kick for Colombia

82mins: Di Nigerian defence don hear am. Dem neva rest from di follow-up attacks of di  Colombians

80mins: Nigeria try attack for di firs time since 2nd half start but Espiteleta stop dem.

78mins: Anoda good sve by Omilana. She save Caicedo spin from di left flank.

77mins: SUBSTITUTION. Gravatito enta for Quintero for Colombia

75mins: COOLING BREAK

74mins: Colombia no dey give Nigeria breathing space at all. Dem don dominate di midfield.

72mins: Colombia goalkeeper, Agudelo just dey on holiday. Di Flamingos neva test am since di beginning of  2nd half

70mins: Good save by Omilana afta shot by Caicedo. Nigeria almost concede own goal.

69mins: Colombia dey do evri tin to break di Nigerian defence.

66mins: OFFSIDE. Linesman catch Quintero for offside.

64mins: Corner for Nigeria. Di Flamingos no ue am well. Usani cross too deep.

61mins: Nigeria goalkeeper Omilana save hot shot from Munoz. Di ball go corner.

59mins: Corner kick for Colombia. Folorunsho head Caicedo ball go corner

57mins: Bello try find Ajakaye wey shoot di ball go wide. Colombia goalkeeper just di ball waka pass

55mins: Good skill by Munoz to comot di ball deom Folorunsho.

53mins: Ref don stop play afta Bello clash wit Ortegon

49mins: MISSED CHANCE. Munoz miss one on one chance wit Omilana. But e miss am

48mins: MISSED CHANCE. Munoz miss one on one chance wit Omilana. But she miss am

45mins: SUBSTITUTION. Ajakaye enta for Adeshina

First Half

45+4mins: Mosaku don call for medical help afta Espitaleta hit her from back

45+2mins: Nigeria clear Colombia free kick comot. Di Flamingos don try regain dia possession

45mins: Nine attempt on goal for Colombia , 5 dey on target while Nigeria don get 8 attempts but all na off target

44mins: DISALLOWED GOAL. Nigeria 0-0 Colombia

Colombia bin score but ref say na offside.

43mins: Edafe long throw from di right no dey enough to threaten di Colombain defense

41mins: FOUL for Nigeria. Guzman set leg for Mosaku.

40mins: Nigerian winger Usani shoot di ball from outside. But e go wide

38mins: Caicedo dey run down Nigeria defence from evri angle.

36mins: Rodriguez fall inside Nigeria 18 box referee say no be foul.

VAR don also check, say no be foul. Nigeria don escape possible penalty.

35mins: Bello run through di Colombian defense but dem stop her before she enta 18

33mins: Game don resume afta di teams go on 2mins water break

29mins: HIT BAR. Mary Espitaleta freekick from 25 yards out hit bar. Colombia for dey one goal up

28mins: Yellow card for Etim afta she bring down Caicedo 25 yards out

25mins: MISSED Chance. Munoz miss goal opportunity afta beta cross by Rodriguez.

She shoot di ball wide.

20mins: Game don resume wit Nigeria holding possession.

18mins: Espitaleta don go down. She neva recover from di head clash she get wit Etim.

Medics dey attend to am.

17mins: Free kick for di Flamingos but Espitaleta clear am comot.

14mins: FOUL. Strong challenge on Etim by di Colombian defender. Ref no giv card despite di head clash

10mins: Colombia don try spend some time on di ball. ,unoz dey press di Nigerian defense

8mins: CORNER for di Flamingos but Colombia clear am comot.

6mins: Nigeria dey press Colombia. Dem dey dia box for more dan 3mins now.

1min – Dis semifinal match don start, Nigeria wear green while Colombia wear red.

‘We need to create chances’

Head coach of di Flamingos, Bankole Olowookere don tell Nigerians to relax  dia mind say dem don ready well well to face Colombia.

E tok afta dia last training session on Tuesday.

“Na operation Colombia must go down and Nigeria must move forward, we want enta di final, and we no go fit enta di final if we no remove Colombia,

“We dey do evritin possible to make say say we achieve our aim so dat millions of Nigerians go still get hope say we go win di Cup”

Oga Bankole tok about dia chances to score plenti goals for di match.

“We fit miss plenti scoring chances sake of say dis programme na to develop players, na gradual process, wetin dey important for us na make we create chances “ e tok

Nigerian players morale dey high for dis game wit plenti ginger say dem go win.

According to local media, Head Coach of Colombia, Carlos Quintero say dem get big opportunity to qualify for di finals.

E add say dem no get any issues for dia side sake of say one of dia biggest players wey bin get injury don dey okay now.

So as e be so dem dey ready to face Nigeria for di ogbonge semi-final match today.

Flamingos bin lose dia first match 2-1 to Germany , dem beat New Zealand 4-0 and Chile 2-1.

Colombia lose dia first match 1-0 to Spain, beat China 2-0 and Mexico 2-1 to enta di quarter-finals wia dem overcome Tanzania.

Nigeria and Colombia don meet before?

Nigeria play Colombia for di first time for Azerbaijan for 2012, di Flamingos beat dem 3-0.

Di second time dem meet na for Costa Rica for 2014, di match end 2-1 in favour of Nigeria and dem use am qualify for quarter-finals.

Na di first time di two kontris dey face each oda for semi-finals.

Nigeria bin don qualify for three quarterfinals before di World Cup for India 2022, while Colombia neva pass group stage before now.

Nigeria U-17 vs Colombia U-17 lineup

Nigeria XI: 1. Omilana (GK), 2. Edgar, 3. Usani, 5. Adesina, 6. Oyinlola, 7. Bello, 8. Emmanuel, 10.Afolabi, 12.Folorunsho, 18.Mosaku, 20. Etim

Colombia XI: 1. Agudelo L. (G), 2. Espitaleta, 3. Motta, 13. Guzman, 8. Hernandez, 11. Caicedo, 9. Munoz, 16. Ortegon, 5. Perlaza, 18. Quintero, 10. Rodriguez.

BBC Pidgin go drop live updates of di match wen e start at 12:00.