Archbishop Desmond Tutu dies: South Africa Anti-apartheid activist death on Boxing Day

Archbishop Desmond Tutu dies: South Africa Anti-apartheid activist death on Boxing Day

BBC
During di long years wen Nelson Mandela dey in prison, Archbishop Tutu speak out against di regime – and win di Nobel peace prize in 1984 for im efforts.

Archbishop Desmond Tutu don die, South Africa President office confirm on Sunday.

Archbishop Emeritus Desmond Mpilo Tutu na di last surviving South African laureate of Nobel Peace Prize and one man wey help end apartheid rule for South Africa.

Archbishop Tutu death occur inside Cape Town at di age of 90 on Sunday 26 December 2021,

President Cyril Ramaphosa don express sadness on behalf of all South Africans sake of Tutu passing.

President Ramaphosa also express im heartfelt condolences to Mam Leah Tutu, and di Tutu family.

Desmond Tutu na iconic spiritual leader and global human rights campaigner.

Archbishop Desmond Tutu dies: South Africa Anti-apartheid activist death on Boxing Day

Getty Images
Desmond Tutu inside Cape Town in 2019

In October 2021 oga Tutu bin celebrate im 90th birthday wey South African president Cyril Ramaphosa call am, “national treasure and global icon”.

Before Tutu death fake tori bin comot more than once on top di death of di beloved clergyman.

For 2018, tori comot say e bin die for US wia im go for visit.

Tutu dey popular for how im use im position of priest to advocate for non-violent end to apartheid for South Africa.

Na wen Tutu bin dey 88 for 2019 na im dem admit am for hospital for one infection.

During di long years wen Nelson Mandela dey in prison, Archbishop Tutu speak out against di regime – and win di Nobel peace prize in 1984 for im efforts.

Nomsa Maseko looks back at the life of Desmond Tutu
The British Broadcasting Corporation

We eye still dey dis tori wey just land and we go bring una more as e dey comot. Make una load di page again to see di full tori.