Sudan coup de’tat: Gen Burhan confirm military coup, Sudan soldiers dissolve civilian rule

AFP
Demonstrators block road inside di capital, Khartoum to protest di arrests

Sudan military don dissolve civilian rule, arrest political leaders and declare state of emergency.

Gen Abdel Fattah Burhan, wey don dey head di joint council with civilian leaders, blame di coup on political fight-fight for di council.

Sudan military chief General Burhan don confirm coup in for di konri after he overthrew di goment and declare di coup d ‘ etat.

Sudan coup de'tat: Sudan soldiers dissolve civilian rule, AU, US react to military coup

AFP

Protesters don enta streets for di capital, Khartoum, and pipo dey report gunfire.

Meanwhile, African Union Commission and di United States don react to di coup wey dey happun for di kontri.

Inside statement, di AU commission chair, Moussa Faki Mahammat, call for di release of Sudan political leaders plus ask di military to respect human rights.

Reuters
Possible coup attempt dey happen for Sudan, according to reports wey land on Monday.

US don draw ear give Sudan say e fit lose im support if di military forcefully take over power.

America say dey deeply alarmed for di kain reports wey dem dey hear say military take-over di transitional goment.

US Special Envoy for di Horn of Africa, Jeffrey Feltman, wey bin recently dey Sudan, na im yarn dis on Monday.

Oga Feltman add say di forceful military takeover go dey against di Constitutional Declaration and di democratic desire of Sudan pipo, dia fore e dey unacceptable.

Sudan soldiers arrest Prime Minister Abdalla Hamdok take am to “unknown location” as alleged coup dey happun for di kontri.

Di kontri Ministry of Culture and Information wey give dis report for dia Facebook page post say:

“Afta im refuse to endorse di coup, one force for di army arrest Prime Minister Abdullah Hamdok, move am go unknown location.

“Sudan Prime Minister Abdalla Hamdok, for message from im house arrest, ask Sudan [pipo] to hold on to peace and occupy [di] streets to defend dia revolution.”

Di development dey come just hours afta soldiers detain several civilian officials of di transitional goment.

Getty Images

Sudanese Professionals Association, di group wey play prominent role for di protests wey lead to di overthrow of longtime President Omar al-Bashir from power for 2019, don call im supporters to come out to the streets to resist wetin im call “military coup” for di kontri.

One journalist for di capital, Khartoum, tell BBC say crowds dey gather across di city but military presence no too dey.

Correspondents say dem don switch off internet in order to stop pipo from mobilising.

No immediate comment from di military don comot for now.

Sudan don dey on edge since one failed coup plot last month open bitter relation between military and civilian groups.

Reuters
Pipo gada around as smoke and fire na im dem see on di streets of Kartoum, Sudan, in di middle of reports of a coup on Monday October 25, 2021.

Di two groups suppose dey share power following di 2019 removal of former leader Omar al-Bashir

President Omar al-Bashir comot for coup for April 2019.

Last week, many cabinet ministers take part for one big protests inside several parts of Khartoum and oda cities against di possibility of military rule.

Di military head of di Sovereign Council don before now insist on im commitment to di transition.

We eye still dey dis tori wey just land and we go bring una more as e dey comot. Make una load di page again to see di full tori.