Abesim murder in Ghana: Suspected serial killer wit human flesh for fridge bore Ghanaians

One 28-year-old man dey tell Ghana police what he know about de suspected murders for de Bono Region.

Ghana Police dey investigate de murder of three people wey appear like serial killings.

Di suspect wey be architect, chop arrest on Friday for Alaska near Abesim for Bono Region.

Ghana Police Service say de arrested suspect don allegedly murder 12 and 15years pikins plus anoda pesin wey dem dey try identify.

Abesim murder in Ghana: Suspected serial killer in Bono Region wit human flesh for fridge bore Ghanaians

iStock
Suspected serial killer wit human flesh for fridge bore Ghanaians

Ghanaians dey bore as dis dey remind many of de missing Takoradi girls palava wey ben occur recent.

De police tok for statement say dem effect de arrest after dem search en quarters”.

“De police with collaboration from de community pipo don arrest one suspect wey dem give en name as Richard Appiah wey currently dey police grips dey assist with investigation”.

Dis be according to de statement signed by Assistant Commissioner for Police Kwesi Ofori.

De Acting Inspector General of Police Dr. George Akuffo Dampare don give directives to fast track de investigation, de senior police official tok.

IGP Dampare order CID officers for de police headquarters for Accra say make dem give technical support to de Bono regional police CID for Sunyani take reveal de person wey kill de three pipo for Abesim.

killing three persons for Alaska near Abesim for Bono region

BBC

Abesim murder in Ghana: Background

Tori wey we dey gather ontop dis crime be say, de suspect don deceive de 12years old boy from de football pitch take go en (suspect) room before en kill am.

As de father of de diseased boy dey search for en pikin for evening at about 5:40pm, ebi there wey alarm come blow say dem see de boy plus Appiah.

Dem follow up go break into de suspect en room go discover human body parts for fridge plus three heads as dem report de mata give police.

De small boy en body dey flat for ground.

According to eyewitness account wey local media report, further search for de room of de alleged killer reveal say, na human flesh plus human head wey dey de room.

Appiah currently dey assist de police make dem unravel circumstances leading to de death of de pipo.