Murtala Nyako: Court rule say ex-Adamawa state govnor get case to ansa over alleged money laundering

Murtala Nyako

BBC

Di Federal High Court for Abuja on Monday dismiss di no-case-submission of former Govnor of Adamawa State, Murtala Nyako as dem ask am to enta im defence ontop di N29 billion fraud case wey dey im head.

For di ruling on  Monday, Okon Abang, di trial judge, dismiss Mr Nyako no-case-submission.

Nigeria anti-graft agency, di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC dey prosecute di former govnor alongside im son, Abdul-Aziz Nyako; two companies, Sebore Farms and Extension Ltd and Pagado Fortunes Ltd, plus oda defendants on a 37-count of criminal conspiracy, stealing, abuse of office and money laundering.

Di Federal High Court, Abuja bin fix Monday July 19 to either rule on a no-case submission wey former Adamawa State Governor, Murtala Nyako (rtd), im son and three others file, or deliver judgment ontop di case.

Justice Okon Abang fix di date after counsels for di case bin conclude arguments on the no-case-submission wey di defendants file.

Di trial don dey on since 2015.

Who be Murtala Nyako?

Dem elect Vice Admiral Murtala Nyako, as di Executive Governor of Adamawa State, im take office for May 2007.

Before den, e bin serve for di Navy, at one time e be military governor of Niger State, and dem also appoint am as di Chief of Naval Staff for December 1989

Dem born Murtala Hamman-Yero Nyako for Mayo-Belwa, Adamawa State on 27 August 1943.

Nyako enter politics for 2006. Dem elect am as Governor of Adamawa State for April 2007.

For February 2008, the Election Petition Appeal Tribunal annul im election, ontop accusation of electoral malpractices.

But afta fresh election, dem re-elect Nyako afta e chop landslide victory where e take all di 21 Local Government Areas.

On July 15, 2014, dem impeach di governor as di state House of Assembly chook eye inside report of one investigative panel wey probe allegations of financial misconduct against am.

But on 11 February 2016 di Federal Court of Appeal declare di impeachment null and void and order make dem pay am all im entitlements from di date of impeachment be paid to him. Supreme court uphold di judgement on 16 December 2016 but refuse to reinstate am.