Nigeria Police Recruitment 2020: How to update your record for NPF recruitment portal

Nigeria Police Force don advise all candidates wey don submit dia application for di 2020 recruitment exercise to update dia record.

Dem open di portal from Friday 31 July 2020 for pipo wey dey seek employment to login and update dia records.

See how you go update your record

Visit Lhttp://www.policerecruitment.gov.ng/nk

Enta your National Identity Number(NIN) for di space wey dem indicate.

When you enta your NIN , you go need provide all di details wey dem ask to update your record.

You go upload scanned copies of your

  • 0’level Result
  • Birth certificate/or any oda document wey you fit use show your age
  • Certificate of Origin wey show wia you come from for di kontri.

Afta you upload, you go click on di consent box and click submit.

Print confirmation slip and make you take note of your Application Reference ID(you go need am during di stages of di recruitment exercise to identify yourself.

Download and print Guarantor’s form.

You get any complain?

Call 08100004507

Send email to [email protected] or [email protected].