Unilorin student beats lecturer: University management expel student wey assault female lecturer

University of Ilorin management don expel student wey assault one female lecturer.

Di school authorities bin find Salaudeen Waliu Aanuoluwa wey dey Department of Microbiology guilty for beating female lecturer wey dey for im department.

Inside statement wey di University Director of Corporate Affairs, Mr. Kunle Akogun give, e say di school make decision to expel Salaudeen afta di Student Disciplinary Committee tok wit am.

Di committee give am 48 days to appeal to di Vice-Chancellor in case im feel dissatisfied wit di decision.

“Salaudeen dey police hand since for further necessary action,” Akogun tok.

According to di statement, inside letter wey di University Registrar write give Salaudeeen e say, “You go remember say you appear before di Student Disciplinary Committee (SDC) to defend yourself concerning di allegation of misconduct against you.

“After due consideration of all evidences before am, di Committee dey convinced beyond any reasonable doubt say e get allegation of misconduct against you.

“Accordingly, e don recommend to di Vice-Chancellor, who exercise di power wey im get, direct say make dem expel you Salaudeen Waliu Aanuoluwa from the University.

“Accordingly, you dey hereby expelled from di University wit immediate effect.”

Di school ask Salaudeen to submit every property wey belong to di school to including im ID card to di Dean of Student Affairs and make im no near di campus again.

For inside statement wey di school Vice Chancellor Dr. Fola Olowoleni bin first sign wen di incident first happun, di school confam say di incident happun on Thursday, 11 November.

Di 400 level male student of di Department of Microbiology assault one female lecturer, identified as Mrs Zakariyyah for di same department.

Di university say dia security personnel dem don take Salaudeen Wasiu Aanuoluwa into dia custody for questioning and im go later appear before di Student Disciplinary Committee.

School authority say dem go later hand am over to di police for further investigate.

Di Academic Staff Union of Universities (ASUU), University of Ilorin (Unilorin) Chapter, don also condemn di attack on di female lecturer by di student.

Prof. Moyosore Ajao, di Chairman of di association follow tori pipo tok for Ilorin on Monday say dem no go allow di act go unaddressed.

“No be just because di lecturer na female but because she be human being and violence no dey tolerated for ASUU, more or less for one university wia character and learning be di essence of it.

“ASUU dey patiently wait on wetin di university management go do before we now apply our own action.

“But I fit tell una say di Union no dey sleep on di mata and we no go allow dat kain mata to go under di carpet,” im tok.

‘Why di student beat im lecturer?’

Dis na di question wey dey everybody mouth afta di video go viral on social media over di weekend.

From wetin we gather from di school authority, di tori be say di student allegedly attack di lecturer for inside her office.

Claims dey say na because di lecturer refuse to help am over im failure to do di mandatory Students Industrial Work Experience Scheme.

School authority say di lecturer don dey recover afta di ugly incident happun wey make dem rush her go hospital.

Di student papa also react

Di papa of Waliyu Anuoluwapo Salawudeen wey im nickname be Captain Walz say im no sabi wia all dis wahala dey come from wey im pikin go beat lecturer.

For one interview wey im do wit BBC Yoruba, Im tok say Waliyu younger brother bin first call di family attention to one incident wey happun on Wednesday, a day before im attack im lecturer.

“Im brother tell me say Waliyu comot from inside im apartment naked imsef for outside.

“I tell am make im find some pipo wey go hold am and I go come Ilorin di next day.

“On Thursday wen I reach Ilorin, I call im brother, na im tell me say Waliyu don go beat im lecturer.”

Im papa add am say Waliyu no dey do like dis before, say e no get bad character for house.