Tribunal declare Gboyega Oyetola as winner of Osun govnorship election

Di election Tribunal don declare Oyetola as winner of Osun govnorship election wey happun for July 16, 2022.

Di tribunal wey justice Tertsea Kume lead say na di former govnor be di winner of di election.

Afta dem establish over voting, di chairman of di panel hold for im judgement say dem conduct di election wit ‘substantial noncompliance’ wit di provision of di law.

Di Osun State Governorship Election Petition Tribunal bin siddon for Osogbo, di state capital to deliver judgement on di outcome of di election on Friday.

Na di candidate of di All Progressives Congress (APC), Gboyega Oyetola, bin file one petition for di tribunal to challenge why di Independent National Electoral Commission declare di candidate of di People’s Democratic Party (PDP), Senator Ademola Adeleke, as di winner of di election wey hold on July 16, 2022.

Di electoral body announce Ademola Adeleke as di winner of di governorship election wit 403, 271 votes and Gboyega wey bin dey contest for second term get 375, 027 votes.

Di former govnor ask di tribunal to nullify di election,  ontop accuse say mago-mago, say dem rig votes for some polling units.

E also challenge di authenticity of di West African Examination Council (WAEC) certificate wey Governor Adeleke present among oda tins.

Na Justice Tersea Kume head di three-man election petitions tribunal on January 13 and adjourn indefinitely for judgement afta parties for di petition adopt dia final written address.

‘Stay safe’- police warn residents as dem dey wait di verdict

Di Osun state police don send circular ahead of di verdict of di tribunal wey dey meet on Friday.

Di state police sama warning give residents to dey vigilant as di court wey hear di election petition go announce judgment on 27 January 2023.

For press release wey di tok-tok pesin of di Osun Police, Yemisi Opalola release on Thursday, e say dem go do everything necessary to make sure ogbonge security dey for di citizens.

‘We no go allow anybody disturb di peace of di state, no mata di outcome.”, di police add say dem go work wit oda security guards to make sure say pipo no violate di law.

Opalola say dem go make sure say adequate security dey for di state before, during and afta di verdict.

Tight security for court

Security tight as Tribunal dey deliver judgement on di Osun govnorship election on Friday.

Police don close all roads wey lead to di State High Court, wey be di venue as early as 6 o’clock on Friday morning to restrict human and vehiclar movement around di area.

Combined security operatives dey do stop and search and controlling traffic at Lameco junction and Okefia roundabouts.

Dem first restrict entry into di tribunal hall to court officials, lawyers and newsmen before dem come later allow some representatives of di two political parties, di All Progressives Congress, APC, and di Peoples Democratic Party, PDP enta.

Tension dey high as both parties and dia counsels dey wait for di judgement from di Justice Tertsea Kume led panel.