N-Power shortlist 2020: See wetin go happun next for Batch C, 2020 successful candidates

BBC Pidgin find out say di supervising ministry of di N-Power programme for Nigeria don start to review wey applicants submit .

Di Federal Ministry of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development say dem go communicate through dia official channels wen dem release di list of successful candidates for di Batch C programme

Candidates wey enta for di Batch C 2020 N-Power programme wey Nigerian goment establish to employ young pipo between di age of 18 and 35 dey wait for informate to sabi who goment don shortlist to join di third stage.

Di registration bin close on Sunday, August 9 and almost four weeks afta e end, tori bin dey go upandan for about shortlisted successful candidates for di 2020 programme.

But authorities wey dey in charge of di programme, come out to tok say di tori na fake news.

Wen di shortlist of N-power Batch C candidate go comot?

Di minister of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development, Sadiya Farouq say dem receive ova 5 million applicants for N-Power Batch C programme and she promise say di process to select di successful candidate no go get mago-mago inside.

Dem neva tok wen dem go release di list of candidates wey dem go piuck to join di Batch C or wen dem go begin work for dia primary assignment.

Dis na wetin go happun nxt for Batch 2020 successful applicant.

Wetin go happun next to Batch C applicant?

Di next stage na for goment to release di list of successful candidate.

Afta dat, dem go set date wen dem go resume for dia places of primary assignment to begin work.

Dem dey expected spend 24 months on di programme,

Apart from di same period wey di online registration dey start, di time frame of wen dem dey shortlist candidate dey different.