See di church wia dem dey drink ‘ogogoro’ alcohol during service to connect wit God

Some pipo go say in order to near dia maker, dem go run far from some tins; For South Africa Gabola church na alcohol dem dey use “connect with God”.

E get plenty churches wey dey around di world but di churches wey dey like South Africa Gabola church no many.

Di meaning of ‘gabola’ for South Africa na ‘drinking’ for SeTswana language.

Gabola Church International

BBC

Gabola church dey believe say im members dey connect wit God wen dem drink too much alcohol during church service.

Di founder of Gabola church, Pope Tsietsi Makiti say di main reason why im found di church na to accommodate pipo wey dem see as drunkards.

E say dis na “pipo wey dem reject from dia colonial churches but now dem fit come together as one… to enjoy worship and drink liquor as dem want at di same time”.

Gabola Church International

BBC

“Everybodi for dis church plus di bishops, di archbishops and di owners of di taverns and di oda members don alreadi swallow something before dem come church”, Pope Tsietsi tok.

Im also describe di experience wey dem dey get wen dem drink alcohol, he say: “We dey a bit under di influence but na di influence of di Holy Spirit, we fit hear from di Holy Spirit from above among us.”

Currently South Africa dey go through im second phase Covid-19 and goment don place temporary ban on di sales of alcohol and to gather together to drink alcohol for di kontri to reduce di wahala on hospitals during di pandemic.

South Africa goment bin once arrest Pope Tsietsi for breaking lockdown order but im later tok say di church dey try change im ways sake of di coronavirus rules.

Gabola Church International

BBC