How Nigerians and South Africans dey take demsefs catch cruise by ordering and cancelling online taxis

Nigerians and South Africans online fight-fight don enta anoda dimension as citizens of both kontris dey use demsefs catch cruise by ordering taxi online and cancel di ride.

South Africans bin dey for dia house and dey order Bolt ride wey worth ova 20,000 naira.

Dem go set dia map as if say dem dey Nigeria and begin order ride, and Nigerians begin retaliate by ordering South African rides from di comfort of dia homes.

Nigerians on X, formerly Twitter, dey mobilise fellow citizens to go on the e-hailing apps and book rides in South Africa to show di power of numbers.

Some Nigerians on X dey mock South Africans for starting di taxi ordering ‘war’ wey dem fit no win sake of say Nigerians get more numbers dan dem.

We dey update dis tori

Source