Brazil declare 3-day mourning for victims of plane crash

Site of plane crash for Sao Paulo region

EPA

Brazilian President Luiz Inácio Lula da Silva don declare three-day of mourning afta one tragic plane crash for di São Paulo region.

Di president announce ontop im X page on Saturday say, di kontri go mourn di 61 pipo wey die on Friday.

“In memory of di 61 victims of di tragic accident in Vinhedo, we don declare three days of official mourning in di country,” president Lula tok.

Plane

Getty Images

Evri one wey wey dey inside di Voepass flight wey crash for di Brazilian state of São Paulo die, according to local authorities for Valinhos, near di city of Vinhedo, wia di plane bin go down.

Dem say di plane bin carry 57 passengers and four crew members.

Di twin-engine turboprop plane bin dey fly from Cascavel for di southern state of Paraná go di main airport for São Paulo city wen e crash for di town of Vinhedo, Voepass airline tok.

Footage wey dey spread on social media how one plane dey descend vertically, and e roll as e fall.

Local authorities say di plane land ontop one residential building.

For di town of Vinhedo for São Paulo state, wia di plane crash, officials say only one home for di local condominium complex dey damaged.

None of di residents dey hurt, according to city officials for Valinhos.

Brazil GloboNews television network show fotos of one large area wey dey on fire and smoking wreckage for one area wey house plenty.

Police and fire services dey for di scene and dem don alert local hospitals.

According to tracking website Flightradar24, dem build di plane for 2010 and e leave Cascavel for 11:56 local time (14:56 GMT). Di last signal dem receive from di aircraft na about one hour and half later.

Di President of Brazil, Luiz Inácio Lula da Silva, bin hold one minute silence for one event wia e bin dey speak.

E post di news of di crash on social media: “Veri sad. All my solidarity to di families and friends of di victims.”

Seven firefighting teams dey involved for di emergency response.

Di Fire Department of São Paulo bin post on X: “Aircraft crash, 7 teams dey involved, so far only dis information.”

Local authorities say di nearby town of Valinhos don send 20 emergency personnel to di plane crash site for di town of Vinhedo for São Paulo state.

“Twenty men bin dey mobilised, including three vehicles from di Valinhos Municipal Civil Guard and one vehicle from di civil defense,” Valinhos City Hall tok for one statement.

Airplane manufacturer dey ‘fully engaged’ to support investigation

Di maker of di airplane wey crash, ATR, don release one statement afta di incident.

Di Franco-Italian manufacturer tok say dem don dey informed say accident happun for Vinhedo, Brazil, wey involve one of dia planes, ATR 72-500.

“Our first thoughts dey wit all individuals wey dey affected by dis event,” di statement tok.

Dem add say ATR specialists dey fully engaged to support both di investigation into wetin cause di crash and dia customers.

Source