How Formula One take become global motorsport?

Brad Pitt and Damson Idris for di UK Silverstone circuit for di filming of "Formula One"

Getty Images
Brad Pitt and Damson Idris for di UK Silverstone circuit for di filming of “Formula One”

“Formula One” na one of di feature Hollywood feems wey most pipo dey wait for. Ogbonge Hollywood actors Brad Pitt, Damson Idris and plenti world championship racing car drivers go act for di feem. Na 2025 di feem go come out.

Di high expectation about di feem show how Formula One (F1) dey popular and wetin e don become across di world.

Hundreds of millions of pipo evri year dey watch di Grand Prix races, wey dey happun across six continents.

Formula One na di fastest motor sport of all, and di champion drivers don dey famous for di world.

How Formula One become di fastest motorsport?

Since di first F1 Grand Prix happun for di Silverstone circuit for UK for 1950, e don gain front position as di fastest type of motor racing.

Di speed record for F1 car na 378km/h (234.9mph). Di nearest rival to F1 for speed na di US IndyCar series. Di top speed for IndyCar na shade faster – 380km/h (236 mph).

However, F1 cars dey faster around corners dan IndyCars, wey make dem faster across a whole lap.

Jack Brabham dey inside im Cooper racing car for Monza, 1959

Getty Images
Australia’s Jack Brabham dey inside im Cooper on di Monza circuit for Italy for 1959

For di 1950s, F1 cars bin dey reach maximum speeds of about 180 mph. Di fastest of dat decade na di Cooper T51 wey Australian Jack Brabham, wey bin win di 1959 world championship use.

Na di first F1 car to get engine for di back. Within two years, evri oda racing car manufacturer don follow di style.

For 1966, speeds increase as dem begin double di sizes of di engines, from 220 horsepower to ova 400 horsepower.

For 1968, Lotus produce one revolutionary new design of car wey feature aerofoil wings and spoiler wey dey reach speeds near 200 mph.

Dis features increase di “downforce”, e mean say dem bin dey push air down on di car. Dis air wey dem dey push down di car make di car balance for ground well and e fit drive for corners safely wit greater speeds.

Wings and spoilers kon become di standard for evri car, sake of safety.

For di 1970s, engine sizes increase to ova 1,000 horsepower and dem bin build cars wit side skirts to give dem beta chance to balance for di track.

For 1978, Mario Andretti Lotus 78 bin break thru di 200-mph mark. Lap speeds bin also rise sharply from here on.

One F1 car, di Brabham BT46B, show face for 1978 wit one fan for di back to hold am for ground. E make driver Niki Lauda win by a huge margin for di Swedish Grand Prix, but dem ban di design sharp sharp.

Jacke Stewart inside im Matra-Ford for Silverstone for 1969

Getty Images
For di late 1960s, dem bin dey give Formula One cars revolutionary new designs

E dey expensive to compete in Formula One?

Di pressure to produce ever faster and more aerodynamic cars makes F1 dey very expensive business for di teams wey dey compete inside.

For 2018, tori be say Mercedes spend $411m a year to develop dia cars, pay dia drivers and carry dem around di world.

F1 bosses don put a limit on annual spending for teams wey dey. For 2024, na $135m.

How Formula One spread across di world?

A Peugeot, with driver and navigator, for di start of di 1906 Grand Prix for France

Getty Images
Di first “Grand Prix” happun France for 1906

F1 grow out of races wey di Automobile Club of France organise. Di first of di races wey dem call a “Grand Prix” happun for 1906.

Di F1 organisation wey dem create for 1946 – di “Formula” for di name mean di set of rules for races and di “One” mean say na di category for di most powerful types of car.

Dem bin dey hold all F1 races for Europe until 1953, wen Argentina bin host one Grand Prix.

For 1958, di first Grand Prix happun for Africa – for Morocco.

For 1976, F1 spread to Asia, wit di Grand Prix wey happun for Japan. Di first F1 for Oceania happun for 1985, for Australia.

Since F1 start, Grand Prix races don happun a total of 75 tracks on six continents around di world.

Recently, Middle Eastern states dey get strong interest to build circuits to host Grand Prix races, to increase dia international prestige and dia tourist appeal.

F1 circuits don dey for Bahrain, Qatar, Jeddah for Saudi Arabia and Abu Dhabi for di United Arab Emirates – and also for Baku for Azerbaijan.

Grand Prix races dey also happun for Mexico City, Interlagos for Brazil, Shanghai for China, Singapore and Baku for Azerbaijan.

Di US host Grand Prix events for Las Vegas, Miami and Austin.

Dem don also stage Grand Prix races for Russia’s Sochi circuit, but F1 don cancel dia race for dia since 2022 – di year wey Russia enta Ukraine by force wey cause kasala.

F1 na di biggest motor sport for di world?

Spectators for one Grand Prix for Australia

Getty Images
Grand Prix races dey draw hundreds of thousands of spectators

F1 dey make $3.4bn as revenues evri year. Di owners of di US racing series NASCAR (F1 closest commercial rival) say dem aim to make $1.8bn in revenues for future years.

Unlike NASCAR and IndyCar, wey mainly appeal almost exclusively to US audiences, F1 get fans across di world.

For 2021, e bin report a global TV audience of 1.55 billion pipo. For 2022 NASCAR bin get an audience of 114 million.

F1 dey also draw hundreds of thousands of spectators to dia Grand Prix races live.

Daytona 500, NASCAR most popular event, dey draw crowds of between 150,000 and 175,000 but di 2023 British Grand Prix bin draw ova 480,000 spectators ova di weekend of races.

F1 owner, Liberty Media, bin don dey try to find way into di US market against NASCAR and IndyCar.

Dis explain why e dey hold no fewer dan three of dia Grand Prix races on US tracks for 2024 (out of a total of 24), and why e dey collabo for di upcoming Hollywood feem.

Who be Formula One biggest stars?

Michael Schumacher celebrate afta e win di Belgian Grand Prix for 1996

Getty Images
Michael Schumacher from Germany bin don win di F1 world championship seven times

Di two drivers wey don win di most F1 world championships na Michael Schumacher of Germany and Lewis Hamilton of Britain. Schumacher win seven titles between 1994 and 2004, and Hamilton win seven between 2008 and 2020.

Di emirate of Dubai award Michael Schumacher for im victories wit one artificial island off dia coast wey contain one luxury house.

Lewis Hamilton dey co-produce di “Formula One” feem thru im company Dawn Apollo.

Ayrton Senna for 1985, behind di wheel of im racing car

Getty Images
Di death of Ayrton Senna of Brazil for di 1994 Sao Paulo Grand Prix shock di world of motor racing

F1 history don also record tragedy. Thirty-two drivers bin don die for Grand Prix races and qualifying laps.

For 1994, di motor racing world bin get shock afta di death of di Brazilian Ayrton Senna, wey bin win di world championship three times.

Im die for one accident during di Grand Prix for Sao Paolo, wen im bin dey lead di race.

Di most recent death na di one of Jules Bianchi of France, wey bin get injury for one accident during di 2014 Japanese Grand Prix and im later die at di age of 25.

Source