African players wey dey chase European glory and history

A split image of Ayoub El Kaabi and Sebastien Haller celebrating goals either side of Ademola Lookman lifting the Europa League trophy

Getty Images
Ayoub El Kaabi (left) and Sebastien Haller (right) fit follow Ademola Lookman to lift a European trophy?

As Europe major club competition don dey end, one African player don already write im name for football history.

Nigeria forward Ademola Lookman become di first player from di continent to score hat-trick for European final as im three goals for Atalanta beat Bayer Leverkusen for di Europa League final on Wednesday.

Di 26-year-old become just di fifth man to score three times for a Uefa final – and di first since 1975 – as im help end di Italian side 61-year wait witout a trophy.

Di win bin dey veri special becos e come against a Leverkusen side wey bin don go 51 matches unbeaten for all competitions dis season.

Wit two more European finals to come, oda history-makers still dey wait for one corner, tori be say all four teams wey dey involved get African representation.

See as BBC Sport Africa torchlight oda men wey don make key contributions and dem fit add to dia trophy cabinets ova di coming weeks..

El Kaabi fit help Greek giants win dia first title?

Ayoub El Kaabi slides on his knees as he celebrates a go

Getty Images
Ayoub El Kaabi don score 32 goals since im join Olympiakos from Qatari side Al-Sadd last August

Despite winning a record 47 Greek league titles, Olympiakos neva fit win a major continental trophy.

Di giants from di port of Piraeus fit break dat record against Italian club Fiorentina for di Europa Conference League next week – and Morocco Ayoub El Kaabi na key player for dia progress to di final.

Di 30-year-old striker na di top scorer dis season competition wit 10 goals, half of dat tally come for di semi-final win ova Aston Villa.

El Kaabi score hat-trick for di first leg, a 4-2 win away from home, and add two more for di return as di Greeks seal a 6-2 aggregate victory.

Fellow Atlas Lions forward Youssef El Arabi and Guinea midfielder Mady Camara also feature for di campaign.

Di fact say di final on Wednesday, 29 May go shele for di home of rivals AEK Athens go make a title win sweeter for Olympiakos.

Standing on dia way na La Viola, wey Angola forward M’bala Nzola and Ghana midfielder Alfred Duncan dey play for.

Nzola don score three goals – including one injury-time winner for di first leg of dia last-four clash against Club Bruges – and provide two assists, while Duncan don play five times on dia road to Athens.

Haller dey eye Nations Cup-Champions League double

Sebastien Haller celebrates a goal for Borussia Dortmund

Getty Images
Shey Sebastien Haller go dey fit on time to help Borussia Dortmund win a first Champions League title since 1997?

Sebastien Haller fit join one veri select club wen Borussia Dortmund take on Spanish giants Real Madrid for di Champions League final for London on Saturday, 1 June.

Di 29-year-old striker cap a remarkable comeback from testicular cancer wen im score di winner for di Africa Cup of Nations final for Ivory Coast for February.

Now, im fit become just di third man to become a major continental champion for Africa and Europe for di same season.

Former Cameroon pair Samuel Eto’o and Geremi bin help Real to Champions League title for 2000 afta dem win di Nations Cup earlier in di year, wit Geremi still wit Madrid for dia victory for 2002.

Haller get palava wit im ankle for some weeks now but fit dey for bench for Wembley, while Algeria defender Ramy Bensebaini go miss out for Dortmund afta im suffer ligament injury for March.

Di Spaniards, meanwhile, dey chase a record-extending 15th European Cup/Champions League triumph as boss Carlo Ancelotti dey look to retain di trophy.

Brahim Diaz, wey make im Morocco debut for March afta im switching allegiance from Spain, wia im contribute eight goals and seven assists as Real win La Liga.

Dem dey mostly use di 24-year-old as substitute during di Madrid club run to di final but im go hope to win di competition for di first time afta three seasons on loan for Italy wit AC Milan.

Lookman toasts Atalanta triumph

Ademola Lookman celebrates with his family after winning the Europa League title with Atalanta

Getty Images
Lookman celebrate wit im family for di Aviva Stadium pitch afta victory ova Leverkusen

Ademola Lookman bin score for di second leg of Atalanta semi-final win but di Nigeria forward no go eva dream di kain impact im get for di final for Dublin on Wednesday.

Im score twice for di opening 26 minutes and complete im hat-trick wit 15 minutes left to go to put di score at 3-0 for di Italian club first European final.

Im join Real Madrid legends Ferenc Puskas and Alfredo di Stefano, AC Milan forward Pierino Prati, and Borussia Monchengladbach forward Jupp Heynckes to claim di match ball for European final – wit all of dose previous trebles coming in for 1960s and 1970s.

“I always get confidence for my ability,” Lookman tok

“For di past two years I don take my game to a new level and show am on a more consistent basis.

“I dey happy wit di progress I don make but dis na just di beginning. I dey hope for more nights like dis.”

Mali forward El Bilal Toure also collect winners medal afta im come on as a late substitute but di strong African contingent of di defeated German champions Bayer Leverkusen bin dey disappointed.

Lookman Super Eagles team-mates Victor Boniface and Nathan Tella miss out on lifting di trophy afta dem come from bench, but Burkina Faso defender Edmund Tapsoba and Morocco forward Amine Adli start di match but dem no fit influence di outcome.

Ivory Coast centre-back Odilon Kossounou, unused substitute, fail to add di Europa League title to di Nations Cup im bin win for February.

But, Leverkusen get chance to bounce back straight away wen dem face Kaiserslautern for di German Cup final on Saturday, 25 May.

Source