Anthony Madu Nigeria ballet dancer open up about im eye problem

14-year-old Nigerian dancer wey dey di ogbonge Elmhurst ballet school for UK say im get eye problem

Anthony Madu wey bin go viral for 2020 for im ballet dance skill under rain tok am during im interview for Good Morning Britain show.

‘When I find out about my eyes fear catch me well-well becos I think say I dey go blind and I no go fit dance again’’. Anthony tok

‘’But then I do all di tests I need and na case of say e no go worse pass as e dey and e no go better. E go stay like dis forever’’.

‘’Thanks to di school dem help get glasses.’’ Anthony add put but no really tok di name of di eye condition wey dey worry am.

Di 14-year-old get scholarship for one of UK most elite ballet schools, Elmhurst Ballet School for Birmingham.

Three years afta e land UK Anthony life don change, Di Nigerian dancer tok about im dance journey wey start at di age of five.

According to di dance e say im bin know say im wan be dancer but no bin dey sure wia im wan specialize in.

‘’I bin search for different type of dance na so I find ballet and e bin dey really cool and I bin wan do am,’’ Anthony tok .

‘’Three years later I bin dey able to go to dance school and I remember my mama dey telling me say she don find ballet school for me.’’

E tok about di viral video wey change im life, Anthony say im dem feel somehow to watch am back as im look ‘really young’ and ‘completely different’.

Sabina Storrod from Elmhurst Ballet School say: ‘’Di world na Anthony oyster. Talent only fit carry you far, im work ethic and resilience dey totori us.

‘I bin spot di video during Covid and I bin dey impressed. I tell our principal, how we fit help dis young pesin journey?

‘We reach out to im family and Anthony mama say dem don raise some money and im fit come Europe and she [ask] if im fit visit Elmhurst.’

Sabina add say Anthony dey explore different styles of dance and currently im dey enjoy contemporary.

Anthony say im dey miss im favourite food, jollof rice, and im add say im dey look forward to travel back to Nigeria to see im family soon.

Di Nigerian dancer dey take part of a new Disney + documentary film wey follow im journey, from leaving im life for Lagos to moving to UK.

Source