Bayelsa state govnorship election result update

Voting don end in some polling units for Bayelsa state for Nigeria wia di pipo dey vote who go lead dem for di next four years.

Na 16 candidates and political parties dey contest di govnorship election for wey happun on Saturday 11 November 2023.

Di State Govnor, Sen Douye Diri of di Peoples Democratic Party, PDP, dey seek re-election and go face oda candidates including Timipre Sylva of di All Progressives Congress, APC, and Udengs Eradiri of Labour Party, LP wey be youth leader from di state.

Na di Independent National Electoral Commission, INEC, go declare who win.

Move around di map to see di results local goment by local goment wen Inec begin declare am

Source