Wetin court rule for Ghana football star Asamoah Gyan divorce case with im ex-wife afta three years palava

Afta three years of divorce wahala, high court for Accra don order say make Ghana football star Asamoah Gyan compensate im ex-wife wit properties.

Di striker file for divorce as im deny say im be di papa of three pikin im get wit di ex-wife Gifty Gyan.

Di court explain say DNA tests dem do show say Gyan be di papa of di three pikin.

Judge Hafisata Ameleboba don order say make di former black stars striker pay GHC 25k ($2100) each month to im ex-wife as upkeep moni for di children.

Dis moni be aside moni for settlement of medical bills, flight tickets and educational expenses.

Apart from dat, di court also order say make im compensate Gifty wit one house im get for di United Kingdom plus anoda 4-bedroom house for spintex for Accra.

For di divorce settlement, Asamoah Gyan for also give im ex-wife one gas filling station wey also dey Ghana.

Gifty Gyan also go get two cars.

Di court don maintain say di footballer im ex-wife deserve im share of di properties sake of “im substantial contribution to di acquisition of di properties.”

“For di fact say she be di only pesin wey take care of di children for di time Gyan dey outside dey play football, im for get im share.”

For di judgement, di court tok say di evidence say one paper marriage between di two pesin for 2002 at di time Gifty be 17 years, “no be ground to declare marriage void.”

Dis kind marriage still na marriage di court tok.

Di two later marry for 2013.

Consequently, dem don issue ‘decree of nullity’ wia annul dis marriage.

Di high court also tok say dem get evidence say “Asamoah and Gifty dey armorous relationship since 2003 wia dem get two children before dem decide say dem go make dia union formal through di ordinance of marriage.”

Wetin di former striker write for Twitter dey respond to di tori from di court be

“If I get 10 points wia I keep quiet sake if I be matured, wey you get 2 points wia you dey go find public sympathy, den e bi cool. You be very funny. Dis be deep so you fit tink about am.”

Gyan be all-time leading scorers for Ghana wit 51 goals wia im also get record as di record African scorer for di World Cup wit 6 goals.

Di 37-year old don play for Udinese, Rennes, Sunderland, Al Ain, Shanghai SIPG and oda clubs.

For June 2023, di striker announce say im don retire from football.

Source