Wetin be production warrant wey Nigeria court sama against Naira Marley

Nigeria Federal High Court wey dey sit for Ikoyi, Lagos, Nigeria, sama production warrant give one ogbonge Nigeria musician, Naira Marley, on Thursday 5 October.

Justice Nicholas Oweibo wey sit for di Federal High Court, for Nigeria financial capital, Lagos, order di production warrant against Azeez Fashola, alias Naira Marley, wen im fail to show for court to face charges wey di kontri corruption police sama for im head.

Economic and Financial Crimes Commission, (EFCC), bin carry Naira Marley go court on 11-count charges of financial fraud wey include conspiracy and credit card fraud.

But, as court sit on Friday to hear di case, Naira Marley lawyer, Olalekan Ojo, SAN, tell court say im client bin no show for court sake im dey police detention.

Nigeria Police bin detain and dey interrogate di musician for di murder of anoda Nigeria musician Ilerioluwa Oladimeji Aloba, alias Mohbad.

Diafore, Marley lawyer ask court to move di trial go anoda date, while goment lawyer, Bilkisu Buhari, ask court to give production warrant against Marley to make sure say im show for court on di new date.

Justice Oweibo shift di trial date go 30 October, plus sama production warrant against Marley.

But wetin be dis production warrant and wetin e involve?

Production warrant

Production warrant na order wey criminal court dey give to produce pesin wey get criminal case to come face di court in connection wit dat criminal charge wey dey im head.

Dis kain warrant different from search warrant.

Search warrant na court order wey dey allow authorities enta pesin house, office or any compound to search for evidence.

Wit production order, court expect say di pesin wey dem sama dis kain order must to cooperate, allow authorities to get access to, or handover any material wey dey dia hand, wey dey useful for di case wey dem dey do concerning dia legal or financial affairs.

Any security agency, like police, Efcc, DSS fit enforce production warrant.

Add join dis Efcc case, Lagos State Police bin announce say dem get evidence say Naira Marley bin get hand for di bullying and assaulting of Mohbad before im death.

Dis mean say di singer still fit show for court very soon to face case wey connect to Mohbad death.

Source