Nigeria vs Canada highlight: Christine Sinclair miss penalty as Super Falcons hold Canada to draw for Fifa Women’s World Cup

Nigeria 0-0 Canada

Getty Images

Christine Sinclair miss out on becoming di first player to score for six Fifa World Cups as Nigeria hold Canada.

Nigeria keeper Chiamaka Nnadozie keep out Sinclair penalty kick early in di second half as di Olympic champions dey frustrated for Melbourne.

Deborah Abiodun chop red card for Nigeria late in di game, however dem try earn one point for di battle.

Canada and Nigeria get one point for Group B, behind co-hosts Australia.

Di Canadians face Republic of Ireland for dia next game on 26 July, afta Australia beat di Irish team on Thursday. While Nigeria go play di co-hosts Australia.

Dia captain Sinclair bin go into di game aiming to make some personal history. Di 40-year-old forward dey make her 324th international appearance and don score 190 goals for her kontri.

She na one of three players to score for five Fifa World Cups – alongside Marta and Cristiano Ronaldo – and she bin dey destined to make history wen Francisca Ordega foul her inside penalty area.

Referee Lina Lehtovaara award di penalty afta di video assistant referee intervene, however Sinclair effort dey weak and well saved by impressive Nigerian keeper Nnadozie.

Nigeria, wey rank 33 places lower dan Canada for di Fifa rankings, defend deep and stop Canada from many clear chances oda dan di penalty.

Nigeria come closest to a goal in di first half wen a mistake from Canadian keeper Kailen Sheridan allow forward Asisat Oshoala to round her, however shot by di Barcelona forward from a tight angle dey blocked by Ashley Lawrence.

VAR again intervene in di final seconds to instruct Lehtovaara to send off Abiodun for a high tackle on Lawrence, afta di Finnish official originally only give a yellow card.

However Nigeria hold on to give dem fresh hope of getting out of dia Women’s World Cup group for only di third time in nine tournaments.

Deborah Abiodun of Nigeria chop red card from Referee Lina Lehtovaara

Getty Images
Deborah Abiodun of Nigeria chop red card from Referee Lina Lehtovaara