Transfer news: Jorginho, Fernandez, Sulemana, Onuachu all join Premier League Clubs

Players wey dem sell for transfer window

BBC

January transfer window don break transfer record on deadline day.

Dis na as Premier League clubs don spend £2.8billion during di 2022/2023 season.

Dem spend pass £275m on deadline day for English clubs wey increase di former January deadline day record of £150m wey dem bin set for 2018.

Di Premier League financial lead for Europe don grow to di highest level reported.

Di money wey English top-flight clubs spend make up 79% of wetin Europe ‘big five’ football leagues wia dia own January spending fall by 35% from 2022 to £225m.

Chelsea alone spend more for January pass wetin all di clubs for Bundesliga, La Liga, Serie A and Ligue 1 spend combined.

Deals wey complete for deadline day?

Chelsea late catch of Fernandez na di headline deal on deadline day as di Blues scata di British transfer record troway. Na Manchester City bin get di last record wen dem pay £100m for Jack Grealish for 2021.

Player

Fee (year)

Club joining

Club leaving

Jack Grealish

£100m (2021)

Manchester City

Aston Villa

Romelu Lukaku

£97.5m (2021)

Chelsea

Inter Milan

Paul Pogba

£89m (2016)

Manchester United

Juventus

Antony

£82m (2022)

Manchester United

Ajax

Harry Maguire

£80m (2019)

Manchester United

Leicester City

Romelu Lukaku

£75m (2017)

Manchester United

Everton

Virgil van Dijk

£75m (2017)

Liverpool

Southampton

Jadon Sancho

£73m (2021)

Manchester United

Borussia Dortmund

Tottenham announce di signing of full back Pedro Porro from Sporting Lisbon on loan till season end afta which dem fit buy for £40m while Matt Doherty and Djed Spence fit comot.

Premier League leaders Arsenal use £12m take obtain Italy midfielder Jorginho from Chelsea and forth position Manchester United complete loan signing fOr Austrian midfielder Marcel Sabitzer from Bayern Munich.

Southampton end di widow with last minute activities as dem complete club record £22m deal for Ghana winger Kamaldeen Sulemana and Nigeria striker Paul Onuachu.

Bournemouth sign Ukraine centre-back Illia Zabarnyi for wetin tori dey tok na £24m deal and Ivory Coast midfielder Hamed Traore on loan before di summer move move of £20m.

Nottingham Forest also det busy as dem complete deals for Atletico Madrid Brazillian defender Filipe and New Castle midfielder Jonjo Shelvey for money wey dem bot reveal and Paris St Germain goalkeeper Keylor Navas on loan.

Leicester City sign defender Harry Souttar from Stoke City for deal wey fit rise to £20m with add ons and Crystal Palace sign French Naouirou Ahamada from Stuttgart for £9.7m.

Manchester City full-back Joao Cancelo join Bayern Munich on loan for di rest of di season with option to join permanently for summer for £61.5.

Follow us for all di completed deals on dis transfer deadline day.

31 January

Players wey fit move on deadline

Getty Images

Premier League

Sasa Lukic [Torino – Fulham] undisclosed

Nathan Opoku [FDM Field Masters Sporting Club – Leicester] Undisclosed (on loan at OH Leuven for rest of 2022-23)

Jude SoonsupBell [Chelsea – Tottenham] Undisclosed

Harrison Ashby [West Ham – Newcastle] £3m

Diogo Monteiro [Servette – Leeds] Undisclosed

A graphic for Joao Cancelo signing for Bayern Munich

BBC Sport

10:00 Joe Anderson [Everton – Sunderland] Undisclosed

09:00 Marquinhos [Arsenal – Norwich] Loan

International

18:00 Diego Llorente [Leeds – Roma] Loan

17:15 Djed Spence [Tottenham – Rennes] Loan

11:30 Joao Cancelo [Man City – Bayern Munich] Loan

Cancelo leave Manchester City

Joao Cancelo

Getty Images
Joao Cancelo

Manchester City full-back Joao Cancelo don join Bayern Munich on loan for di rest of season, di clubs don confam.

Di deal for di 28-year-old Portugal international include a £61.5m option for di Bundesliga giants to buy di player in di summer.

Hasan Salihamidzic, Bayern board member for sport, say: “We dey very happy say Joao Cancelo go now play for FC Bayern.

“We don sign am on loan now and get di possibility of signing him permanently in di summer.”

Di 28-year-old sign for City from Juventus in 2019 and don make 98 Premier League appearances.

Im don win two league titles and di EFL Cup under Pep Guardiola.

Pipo bin see Cancelo as one of di key players for Guardiola squad due to im ability to enta midfield nd act as a playmaker wen City hold possession.

However, im don play three games since di World Cup and im last two appearances na for di defeats by Southampton and Manchester United.

Di emergence of teenager Rico Lewis and Nathan Ake improved form don make di City manager dey feel confident say e now get plenty defensive options to cover di exit of im player wey wan comot.

Tuesday 31 January na di last day for transfer for European clubs especially Premier League clubs.

Di transfer deadline day go see some failed and successful deals.

These na some of di deals wey fit happun later today.