NBA mourn, as IG order investigation into alleged killing of Lagos Lawyer by police

Di join body of Lawyers, Nigerian Bar Association (NBA) don react to di killing of one of dia member, Barrister Omobolanle Raheem.

Na one Assistant Superintendent of Police allegedly shoot and kill di Lawyer on di 25 December 2022 for Ajah area of Lagos state, South-west Nigeria.

Ikechukwu Uwanna, Chairman, NBA Lagos Branch for statement say di death of Barrister Bolanle no make sense.

“Sadly, we don confam di tori and di deadi body of our collegue dey for Mortuary,” Uwanna tok.

E also say di NBA president Yakubu Maikyau, dey on di mata and dem go ensure say dem get justice.

Lagos State Police Command confam di death of Barrister Bolanle Raheem.

Di tok-tok pesin for di police command SP Benjamin Hundeyin confam di incident to BBC Pidgin and say di officer and two oda pesin wey dey wit am don dey custody and add say police don begin investigation.

Wetin happun?

One Barrister Yvonne wey claim say Barrister Raheem na her boss say di mata happun under Ajah under bridge as di woman dey return from Christmas service wit her husband.

Di officers be like say dem come from di Ajiwe Police Station, Ajah, Lagos State

She tok say Barrister Raheem family call am to narrate wetin happun to her and tell am say dem need lawyer sake of di mata.

“Di police officer na from Ajiwe station. Her husband na im dey drive, Barr. Omobolanle sit for front wit her husband,” Barrister Yvonne tok.

“Di officer ask dem to park and dem bin need di vehicle in front to move so dem fit park well, and immediately di police officer shoot at close range right into her chest. Afta dem see wetin happun, di remaining police officers on duty dia run away,” di lawyer tok.

She say afta a while, some policemen bin come move di deadi bodi to di mortuary for Yaba witout consent from di deceased family members.

‘Anoda crime against lawyer’

Di National Publicity Secretary of di Nigerian Bar Association (NBA) Akorede Habeeb Lawal confam di incident and add say na anoda crime against lawyer.

Barrister Lawal for im Twitter handle say di NBA President Y.C Maikyau dey ontop di mata and dem go ensure say justice dey served.

Police tok sorry to family

Di Lagos State Police Command don tok sorry to di family of Barrister Bolanle Raheem.

SP Benjamin Hundeyin say di Commissioner of Police Abiodun Alabi don dey in touch wit di family and di Nigerian Bar Association since Sunday and im don give assurance say dem go receive justice.

Inspector-General of Police order ‘speedy investigation’

Meanwhile, di Inspector General of Police, Alkali Baba Usman don condemn di shooting ad killing of di lawyer.

For inside statement wey di Force tok-tok pesin, CSP Olumuyiwa Adejobi sign, e say di IGP don order speedy investigation and prosecution of di officers wey dey responsible for di “ugly and unprofessional act wey rubbish di Nigeria Police Standard core values.”

Oga Alkali-Baba tok sorry to di family, friends and colleagues of di victims and warn im pipo to dey more professional as dem dey carry out dia duties.