Aboubakar goal and red card – How Cameroon crash out of di 2022 World Cup

Referee and Aboubakar

Getty Images

Cameroon defeat Brazil but still crash out from di World Cup afta an entertaining encounter for Lusail Stadium.

Vincent Aboubakar head di winner in for stoppage time but im joy immediately turn to disappointment as dem give am s second yellow card for taking im shirt off.

Cameroon bin try but Switzerland victory over Serbia end dia chances of reaching di last 16.

With im side having already qualified afta dia first two games, Brazil coach Tite make 10 changes and Arsenal Gabriel Martinelli take di chance to impress with a fine performance wia di Cameroon keeper Devis Epassy stop am several times.

Di pre-tournament favourites finish top of Group G despite di loss and now go meet South Korea for di knockout phase afta dia dramatic late win against Portugal see dem comot Uruguay, wey beat Ghana, on goals scored.

Referee and Aboubakar

Getty Images

De game as e happun live

SECOND HALF

Full Time

Cameroon 1-0 Brazil

All over! Cameroon claim famous win but e no dey enough to go through to di last 16 because Switzerland win Serbia for di oda group game wey for determine.

92+9 mins: GOAL!

Cameroon Vincent Aboubakar score but collect red card as e pull im shirt to celebrate.

Vincent Aboubakar head di ball into di net

E don go out.

Na big goal but Cameroon still need Serbia goal for di oda game.

90+9 mins: Nine minutes added extra time

88 mins: SUBSTITUTION

Cameroon make dia third change as Moumi Ngamaleu dey replaced by Jerome Ngom Mbekeli.

Few minutes to go.

80 mins: Yellow card

Aboubakar get yellow card afta e bring down Martinelli.

79 mins Cameroon corner

Ekanbi play am, Aboubakar manage to get di ball and fire am but e dey deflected.

78 mins: SUBSTITUTION

Brazil final substitution. Antony dey replaced by Barcelona forward Raphinha.

77 MINS: Cameroon chance

Olivier Ntcham find space some 20 yards from goal and fire low ball but Ederson make di save.

70 MINS: Cameroon 0-0 Brazil

As tins stand one goal no go reach for Cameroon.

67 mins: SUBSTITUTION

Another change for Cameroon as Pierre Kunde DEY replaced by Swansea midfielder Olivier Ntcham.

63 mins: SUBSTITUTION

Karl Toko-Ekambi for Bryan Mbuemo for Cameroon

For Brazil, Gabriel Jesus dey replaced by Pedro.

58 mins: Cameroon goalkeeper dey down afta e try save one corner ball and e fall hit im back. But e go continue.

56 mins: Anoda safe by Epassy from a corner wey Eder Militao fire shot. Dat na six saves di Cameroon goalkeeper don make dis night.

55 MINS: Martinelli again.

E get di ball but e no fit go past Epassi.

Gabriel Martinelli get into di box, cut on im right foot and fire shot but Devis Epassy push am over.

54 mins: SUBSTITUTION

A triple change for Brazil as Alex Telles, Fred and Rodrygo go off and Marquinhos, Bruno Guimaraes and Everton Ribeiro come on.

50 mins: Cameroon Chance!

Aboubakar shot go wide.

Vincent Aboubakar give Ederson work with im good shot but di ball fly just wide off di far post.

KICK-OFF

48 mins: Second half don start.

Cameroon vs Brazil action

Getty Images

FIRST HALF

48+4 mins: HALF TIME!

Cameroon 0-0 Brazil

47+4 mins: Chance for Cameroon!

Cameroon manage to fire a shot on target but Ederson catch am.

Bryan Mbeumo get cross for di back post and head am into di ground but Ederson react quickly and push am away.

45+4 mins: Anoda chance for Brazil

Martinelli get di ball and fire f=but di Cameroon goal keeper catch am and e go to corner.

40 mins: Chance?

Cameroon first clear chance or not as e no work.

37 mins: Antony fire shot but Cameroon keeper catch am.

Antony bin cut inside from di right before bending di shot to score but but e dey too close to Cameroon goalkeeper Devis Epassy.

But dem pause di game as Collins Fai need treatment on di pitch.

33 mins: Dani Alves fire di free-kick ova di wall of players wey gada to stop am but di ball go ova di bar.

31 mins: Foul!

Rodrygo get di ball and dey run down di box before Collin Fai clip am and e fall. Fai collect yellow card. Anoda free kick for Brazil from a good spot.

30 mins: Cameroon 0-0 Brazil

29 mins: Free kick!

Rodrygo fire di shot but e dey blocked by di wall.

27 mins: Yellow card

Pierre Kunde collect Yellow card afta e push Rodrygo. Free kick from a good spot for Brazil.

21 mins: Fred again!

E get di ball from pass and e try to shoot but e go over di bar and staright to corner.

20 mins: Eric Choupo-Moting go forward and through di Brazil defence before Fabinho step in to shoot.

Cameroon keep up di attack but Ederson push away di cross.

17 mins: Brazil dey take control as Gabriel Martinelli look for Gabriel Jesus with di ball inside di box but di Cameroon defence stop di danger.

13 mins: Missed chance!

Martinelli get di ball and head am in but di keeper catch am.

Na Fred pass di ball into di box, right to Gabriel Martinelli head and di Arsenal forward direct am towards goal wey Epassy push over.

Na di first chance of di game be dat.

7 mins: Yellow Card

Eder Militao and Nouhou Tolo dey booked.

Fred Rodrigues also collect yellow card for foul.

4 mins: Brazil get di ball down to di box area but Fred no fit hold di ball well.

I min: KICK-OFF

Cameroon 0-0 Brazil

Game don start!