How soldier kill popular Nigerian Islamic cleric wey give am lift for car

Sheik Goni

BBC
Late Sheik Goni Aisami

Nigeria Police on Tuesday parade two soldiers for Yobe state, north eastern Nigeria unto di killing of popular Islamic cleric Sheik Goni Aisami wey happun last week.

Sheik Goni bin dey travel from Kano state to Gashua town on Friday wia dem later find am dead inside bush wit im Honda car not far away.

Tok-tok pesin for Yobe Police Command Dungus Abdulkarim for statement give detail narration of how one of di two soldiers bin ask Sheik Goni for lift inside im Honda Accord motor.

Di oda soldier also chop arrest as an accomplice to di murder of di cleric wey dem don since bury according to Islamic teachings.

Police say dem bin get distress call wey lead to di arrest of di two suspects wey dey attached to one Battalion unit for Nguru inside Yobe state.

According to di police, di soldier wey be di mastermind bin plan na to rob pesin of im vehicle dat day and im dress in mufti clothes before e leave barracks e bin hide im rifle for di check point a day earlier.

“Im plan na to rob pipo of dia vehicle dat day and e bin dress in mufti and not army uniform, e hide im rifle for Nguru checkpoint.”

“Meanwhile, Sheik Goni Aisami wey be popular Islamic scholar bin dey return from Kano state alone for im Honda car wen di suspect ask am for lift to Jaji Maji town and Sheik Goni agree to help am.”

“As dem dey move na im di suspect ask di cleric to stop as e dey hear one kain sound for back tyre and na wen di Sheik comot to check na im di suspect comot im rifle and shoot and kill am.”

Dis na wetin police tok tok pesin yan.

Di police add say afta im kill di Sheik e drag im body inside bush but di motor wey e dey plan to steal refuse to start.

Dat na how di suspect call im colleague from same barracks wit auto-electrician to come help start di car.

“Na pesin wey dey go farm, sight di corpse and some pipo by di car and im quickly alert Police wey lead to dia arrest.” Officer Dungus add.

Lastly Police say dem go soon charge di suspects to court as soon as dem conclude di investigations.

Who be Sheik Goni Aisami?

Di Islamic cleric originally from Gashua town inside Yobe state don spend many years dey teach islam to many followers.

Despite say e dey Gashua, Islamic work dey see am travel to places wia e dey go spread di word of Islam and di holy Quran.

Di Sheik dey married and get children among which Yobe state govnor don promise jobs after dia killing of di papa.

‘Wetin happun pain me’ – President Buhari

President Muhammadu Buhari condemn wetin happun to di Islamic cleric and also ask Nigeria military to flush out criminals within dia system.

Di presido issue di directive on Tuesday afta police parade di suspects according to im tok-tok pesin, Garba Shehu.

“Dis barbaric murder of a compassionate man wey dey try helep no get place for our training as soldiers.”

“As di commander-in-chief wetin happun pain me especially coming from pesin wey dey trained to protect life.”

“Dis na isolated event wey fit stain di whole military system and Icall on di military to punish di offenders without delay.”

Prayer hold for di cleric

BBC
Funeral prayer for Sheik Goni

Sultan, leader of Nigerian Muslims call for justice

Di Jama’atul Nasril Islam wey be di top islamic body for Nigeria under di leadership of Sultan Sa’ad Abubakar wey be leader of di kontri Muslims call for justice for wetin happun.

E also add say e dey very sad say di Sheik out of im good mind offer lift to di army personnel wey later kill am.

Di sultan call on authorities to treat di issue wit importance and tok say di killing dey shocking and condemn am.

Yobe govnor offer employment to Sheik Goni children

Govnor Mai Mala Buni of Yobe state visit di family of Sheik Goni to condole wit ontop di killing as im also promise two of di children employment wit di state goment.

Di family later visit di govnor to express gratitude over im show of concern to dem.

E also assure dem say di case go receive all di needed attention to make sure dia papa get justice for wetin happun to am.