Family of woman wey allegedly set husband on fire dey on di run – Police

Di family of late Bolu Bamidele wey im wife allegedly set on fire for Osogbo, Osun state Nigeria say dem dey work wit police to look for di lady Ifeoluwa Bamidele.

Police PPRO for Osun state Yemisis Opalola explain to BBC Pidgin say na one of di younger sibling of Ifeoluwa wey raise alarm to di two families say “im sister don set her husband on fire.”

Although different tori dey about wetin happun, Police say dem no fit bank on dat as dem need to see Ms Bamidele so she go fit answer some questions wey dem wan ask her.

Ifeoluwa currently dey on di run.

Na on wednesday 20 July, Police for Osun state say dem dey find one woman ontop accuse say she set her husband on fire.

Tori of di incident bin dey fly for social media say di woman, run afta she allegedly set her husband on fire.

Police PPRO say di mata happun on July 17 for di state and dem still dey find Ms Bamidele.

‘Ifeoluwa family don japa’

Police say late Bolu family tell dem say afta im die for UCH around 4pm on 18 July, family of Ifeoluwa wey bin dey hospital wit dem allegedly run comot.

Dem say non of dem even go di house wia dem dey live and nobody don see dem around or anywia since di gbege burst.

Di chief of di area also put pipo for alert make dem dey monitor weda dem go come home, Opalola add

Police also add say Ifeoluwa allegedly get her husband drunk before she set am on fire.

Wetin happun between di couple

Tori be say Ms Ifeoluwa bin allegedly drop one vex note for her  WhatsApp tori, say her man don push her to di edge.

Di allege Whatsapp note also say “I don always be calm girl and I never do dis for my life but Teebam don push me to di edge”

 “For dis point y’all go weep over myself and am before daybreak. I dey promise y’all dat!!!” Di post wey dem allege say she make tok.

Di Police PRO Opalola say di gbege happun around 11:30 pm for July 17 for dia house for Koka community, Ibokun Local Government Area of di state.

Tori be say na Cairo, for Egypt di man dey stay and e bin just come back for holiday wen di incident happun.

Opalola say pipo rush Bolu Bamidele go Osogbo Central Hospital wia dem later refer am to UCH Ibadan but Oga Bolu Bamidele later die around 4PM on Tuesday.

Wetin eye witness tok

One family member of Ms Ifeoluwa wey wan dey anonymous tok say some of di couple neighbours tell am say dem bin see fire wey dey commot from dia house and dem rush go dia to put out di fire and dem also help rescue Oga Bamidele wey later die for hospital.

 E describe Ms Ifeoluwa as pesin wey dey very quiet, but details of wetin really cause di gbege no dey clear to am.

 Di family member also tok say late Bolu Bamidele dey shuffle between Nigeria and Cairo and na during one of im trip to see im wife na im di incident happun.

E say family members never see any proof say Ms Ifeoluwa don commit suicide as some tori dey spread for social media as dem never see any trace of her body anywia.

E also add say di two couple bin don dey togeda since 2014.

Osun state police also confam say dem still dey find di lady.

Recent cases of domestic violence wey lead to death

 

For January, one business man Alaba Bakare die afta im get gbege wit im wife Motunrayo Bakare, di case dey court now.

Elder broad of late Alaba Bakare bin tell BBC Pidgin say dem di couple don dey get issues for like five to six years now before im death.

For April dis 2022, one 32-year-old miner wey im name be Samuel allegedly kill im wife, Mercy Samuel for Jos, Plateau state wey dey north-central Nigeria.

According to family members, di wife don allegedly dey chop beating for her husband hand before she finally die.

Anoda case be dat of Popular Nigerian gospel singer Osinachi Nwachukwu wey die on April 8, 2022.

Even though tori wey dey out be say Osinachi husband get hand for her death, pipo neva know wetin be di real cause. Di mata currently dey for court.