BBN Cross nude: Former BBNaija housemate address nude video of himself for Snapchat

Former Big brother Naija reality housemate, Cross say na by mistake im post nude video on top Snapchat.

Di reality TV star become number one trend for Nigeria Twitter on Tuesday afta video of im nude surface for internet.

Cross post video of imsef wey im no wear anything on top im Snapchat and later delete am.

Addressing di mata for one interview for one TV show ‘E splash’ on TVC, Cross say “na simple mistake”.

Di 30-year old wey im full name na Cross Ikechukwu Okonkwo say im neva still dey used to social media and im no sabi say Snapchat don already change a lot of features.

“Na just simple mistake and immediately I notice say e don go out, I quickly delete am,” Cross tok for di TVC interview.

“Pipo suppose understand di kain pesin wey I be, I wear my heart on my sleeves, I literarily do dat.

“Dis whole entertainment, media thing and celebrity lifestyle still dey new to me.”

https://www.instagram.com/tv/CVie5WOAYxI/?utm_medium=share_sheet

Cross add say say im still dey try get di concept about wetin to do, wetin not to do as a celebrity.

“E dey choke me, I just wan be me. I just wan live how I want.”

Im also apologise to fans wey dey disappointed wit di video.

Dis dey come for time wey Nigerian singer Tiwa Savage bin reveal say pipo bin wan blackmail her on top sex tape.

Since, di video comot , plenty social media users don share am and some sef dey wonder why di reality TV star go make “dat kind mistake”.

Some Nigerians express disappointment say Cross post im nude video.

Meanwhile some of im fans feel say im bin don post di video by mistake.

One twitter user, @Dafe say “Video of cross no be mistake, dis na PR and according to America, any press na good press.”

See how pipo react:

Wetin you fit no know about di former Big Brother Naija housemate

Cross na former housemates for di Big brother Naija season 6 shine your eye edition.

Im comot di house as one of di top six contestant for di show wey end on October 4.

Im real name na Ikechukwu Sunday Cross Okonkwo.

Di 30 year old na Lagos based fitness enthusiast and entrepreneur.

Im come from Anambra state for southeast Nigeria.

Im dey always describe imself as “a bad boy wit a good heart”.

Cross dey see imself as fun loving, spontaneous and a good dancer wey dey wear im heart on im sleeves.