Flight resumption: Airport go reopen for Abuja and Lagos for domestic operation on July 8

Murtala Muhammed Airport

BBC

Nigeria goment don announce say dem go begin domestic operation on di 8th of July 2020.

Di kontri Minister of Aviation Hadi Sirika wey announce am on Wednesday say, Kano, Port Harcourt, Owerri and Maiduguri go follow on di 11th of di same month.

According to di minister, oda airports go reopen on di 15th.

While di date for international flight resumption go come later.

Dis announcement dey come days afta di oga of di Presidential Taskforce on Covid-19 for Nigeria, Boss Mustapha announce di lifting of di ban on interstate movement and reopening of schools for primary 6, J.SS1 and S.S.S 3 students.

On Saturday, 27 June, 2020, di Federal Airports Authority of Nigeria (FAAN) do dry run exercise for di domestic terminals of di Nnamdi Azikiwe International Airport, Abuja and Murtala Muhammed Airport, Lagos.

Di aim na to test di readiness of di airport to reopen afta coronavirus make dem shut down operations since March.

FAAN don also roll out new guidelines wey passengers must to dey follow wen dem resume.

Some of dem na waiting time wey don increase sake of di plenti checks wey go dey happun now and di use of robots for Lagos and Abuja airports to reduce physical contact sake of di coronavirus.

need to know from wen you land airport to before you check-in