Muhammadu Buhari: Nigeria president say some pipo mercilessly dey against dis kontri

Some pipo dey try frustrate every goment policy to improve security in Nigeria.

Na wetin President Muhammadu Buhari tell di Presidential Economic Advisory Council today.

Di Council tell Buhari say na security challenge dey affect di kontri economy, as dem meet am during during di 6th regular meeting for Abuja.

Buhari say: “Some pipo dey mercilessly against dis kontri” im tok, “we close di borders to control smuggling of petroleum products, and to check smuggled goods, arms and ammunitions.”

“Dem still bring weapons enta di kontri, dem bring rice inside di kontri wit motor and okada. I say make dem shoot anyone wey carry illegal AK-47, still dem no stop.”

Oda tins wey dem discuss for council

Di Presidential Economic Advisory Council also tok about development of irrigation facilitates for di kontri.

Di President say dem go focus on on more development of di facilities as agriculture na good way for di kontri wey take overcome di economic challenge wey dey face am.

Di council recommend make dem find decisive end to all forms of security palava for di kontri, mobilise moni for investment.