Di website to fit register for di N75bn ‘Micro, Small and Medium Enterprise (MSMEs) Survival Fund’ don dey opened and applicants wey dey interested to apply for di scheme fit begin registration.
Di MSME Survival Fund na initiative wey Nigeria goment bin launch to give moni to support businesses wey don suffer sake of COVID-19 pandemic inside di kontri.
- How to apply for MSME Survival Fund registration portal
- Quick facts you need to sabi before you open MSMEs Survival Fund registration portal
At least 1.7 million Nigerians wey get businesses go get opportunity to benefit from dis moni, according to wetin BBC Pidgin find out.
Wetin dey di portal and how you go fit register
Di website wia you go enta to apply na https://www.survivalfund.ng or you fit also apply for http://www.survivalfundapplication.com.
Wen you open di website before you click on Sign Up follow the arrow for di top left wey say Start Here.
- Food prices go continue to increase inside Nigeria in coming months?
- Nigeria goment dey find teachers – See how to apply for UBEC Federal teacher 2020/2021 recruitment exercise
E go carry you go di categories of support wey dey to apply for.
Di first na di MSME Payroll Support, dis one na for business owners wey no fit pay dia staff salary for di past three months.
Di salary supposed dey between 30,000 and 50,000 Nigerian Naira.
Di MSME Grant – dis one na to support di manufacturing sector wit money so fit increase dia production capacity.
Den di Guaranteed Offtake – na medium, micro and small business enterprises na dem fall for dis category as goment go give dem moni to support dia business.
Applicants go click on one of dis three categories wey dem fall into.
Steps and Requirements
Na four steps wey applicants must fill to complete registration
Step 1: Personal Registration
For dis first step, applicants go need register personal details, first and last name, email, phone number, password, gender, date of birth, residential address, state of origin and local government, accept the Terms and Conditions, then register.
Step 2: Activate your account
Applicants go receive one activation code on top di phone number and email address dem take register. You go need dis code to activate your account. Make sure say your phone number or email address near you as you dey register so you go fit complete di registration process.
Step 3: Organisation registration
Afta applicant don successfully activate dia account, dem go need login and register dia organization. To complete dis stage, applicants go need dia CAC Number, SMEDAN Number, Tax ID (e no dey compulsory) and di organisation bank account details.
Step 4: Completing di payroll support application
Under di MSME Payroll Support, applicant go receive one email on list di things e need to complete di application. E go need submit names of im employees wey no go pass 10 staff, proof of previous payments to di beneficiaries and oda supporting documents.
Den applicants go submit.
Goment don release Payroll Support Timetable for di different categories of di scheme.
On Monday 21 September 2020, na only business owners wey dey for Education sector fit register and dem fit register now.
On Friday, 25 September, 2020, business owners for hospitality sector like hotels, bars, cinemas, restaurants and odas fit go register for dia website from 12am.
For Monday 28 September 2020, every oda business owners fit enta di website to apply.
Wen di registration go end?
Registration for every sector go continue until Thursday 15 October 2020 before e end.
Goment don advise all di applicants to take dia time and put all dia application materials in order.