‘Di kain guns wey goment give Community Watch no go make bandits fear’

Di new security outfit go get double barrel gun to fight bandits

BBC
On Tuesday Katsina goment launch Community Watch to tackle insecurity

Discussions dey kontinu across northern Nigeria after Katsina state goment on Tuesday launch security outfit wey dem call Community Watch to help tackle insecurity wahala wey dem dey face.

As goment dey launch di outfit for Katsina stadium some kilometres away for Kankara local goment gunmen kill two pipo dia including di market chairmo to prove how serious di wahala be.

Govnor Dikko Radda during di launch say securing im state na im one number one priority na why e decide to do dis launch.

E also add say e go give di new outfit all di necessary support to succeed and bring end to di kill kill wey dey trouble Katsina for nearly 10 years now.

For a decade now northwest Nigeria don become di most troubled part of di kontri wit kill kill, kidnapping and banditry top of di problems.

According to di Displacement Tracking Matrix na one million, eighty-seven thousand, eight hundred and seventy-five (1,087,875) pipo dey displaced for North West Nigeria.

From dis figure, women and children na di worst hit as na dem constitute di highest number whereas for Katsina alone, na a total of 223,473 persons dey displaced.

Na di Coordinator of the Displacement Tracking Metrix, Dennis Wani make di revelation for less than two months ago for Katsina state.

Official figures no dey for di ones wey lose dia lives over di years because of di kata kata.

Di launch happun for Katsina stadium

BBC
Govnor Dikko Radda say e wan see permanent peace return to im state

‘Di guns no go scare bandits’

‘Di guns no go scare bandits’

Ahmadu Takare na vigilante member for Katsina state wey don lose family members to di insecurity and just recently got im papa released after kidnap e tell BBC News Pidgin say e no dey impressed with di type of guns.

According to Takare wey dem jam face to face wit di bandits na same weapons or one above fit do di trick.

“Dis gunmen na AK47 dem dey hold while wetin gunmen give dis new security outfit na double barrel so bifore dem shoot twice di gunmen fit don shoot like ten times.

“Wetin I expect na for di state goment to give weapons of equal standing since we know wetin dis gunmen dey use.

“Double barrel na wetin some of us dey use for years and e no dey scare dem.”

Manniru Muller security expert wey dey stay Katsina disagree wit Takare adding dat double barrel even dey more powerful na just depending on pesin wey dey use am.

“Double barrel wey goment give go dey carry about 34 catridges inside so with one good shot di damage fit big unlike AK47 whereby na one pesin u fit target.”

“So I no agree say goment must provide AK47 to dis pipo to win di war, with dis effort di problem fit end.”

Some kidnappings wey don happun for northern Nigeria

Jangebe Girls school – Dis one happun on di 26th of February 2021 wia gunmen attack di school in di middle of night pack 317 female students go. Dem spend weeks before dia release.

Gunmen also bin kolobi over 100 students of Salihu Tanko islamic school for May 2021.

E happun as dem dey take Quranic lessons for dia school for Niger state wey dey north central Nigeria.

Gunmen attack Federal College of Forestry on 11 March 2021 wia dem kidnap some students for Kaduna, north west Nigeria.

At di time goment confam say e reach 30 students wey gunmen bin gbab from di school.

College of Animal science – Dis one happun for July 10th 2021 for Zamfara wen gunmen attack di college and kidnap provost of di college, e take days before release

College of Agric Bakura – Dis one happun six months ago when gunmen attack dis college carry 19 pipo go including a staff and im family.

Govt Day School Kaya – Dis na di latest one wey happun on 1st of September last year afta gunmen attack di school in di morning for former Zamfara govnor home town and kidnap unknown number of pipo.

Source