Niger Coup: Ecowas give Niger coup leaders seven days to return power to Bazoum

Leaders of di Economic Community of West African States don give Niger coup leaders seven days to restore power to elected president Mohamed Bazoum.

Di ultimatum dey part of di resolutions wey leaders of di West Africa regional bloc agree on during one emergency meeting dem hold for Nigeria capital, Abuja.

Di leaders also order make all land and air borders between Ecowas kontris and Niger close and dem also put in place “no fly zone” on all commercial flights to and from di kontri.

Dis decision by di Ecowas leaders dey come hours afta Niger coup military officials bin warn both regional and Western powers against military intervention to bring back president Bazoum.

Ecowas say make di leaders of di Niger coup immediately release and reinstate Bazoum as president and head of state of di Republic of Niger. Dem also call for di full restoration of constitutional order for di Republic of Niger.

Di resolutions

For di event, di authorities say if dia demands no dey met within one week, dem go take all measures wey dey necessary to restore constitutional order for di Republic of Niger.

Dat kind measures fit include di use of force for dis effect, di chiefs of defense staff of Ecowas go meet immediately.

Dem go hold accountable all those wey dey responsible for violence and terror against di lives and properties of innocent citizens and residents of Niger.

Dey also condemn di pronouncement of support by foreign goments and foreign private military contractors.

Ecowas leaders say dem appreciate various goments and partners for dia position and solidarity wit di Join bodi. Di leaders also agree to appoint and dispatch special representative of di chair of di authority immediately to deliver dia demands.

In di meantime, di leaders agree to di following measures wey go dey applied wit immediate effect.

  • Closure of land and air borders between Ecowas kontris and Niger.
  • To, no fly zone on all commercial flights to and from Niger.
  • Suspension of all commercial and financial transactions between Ecowas Member States and Niger
  • Freeze of all service transactions including energy transactions.
  • Freeze assets of di Republic of Niger for Ecowas states central banks freeze assets of di Niger and di state enterprises and parastatals for commercial banks.
  • Suspension of measure from all financial assistance and transactions wit all financial institutions.
  • Impose travel ban and asset freeze for di military officials wey get hand for di coup attempt.
  • Di same tin apply to dia family members and di civilians wey accept to participate for any institutions or goment establishment by dis military officials.