Lekki Toll Gate Lagos Nigeria [EndSARS protest]: Police arrest Mr Macaroni, odas on February 13 ‘Occupy Lekki Toll Gate protest’ wit heavy security for Admiralty Plaza

Nigeria Police on Friday night go mount heavy security for ‘Lekki Toll Gate Admiralty Plaza’ ahead of February 13 protest wey protesters dey plan.

CSP Yinka Egbeyemi dey presently lead one team of police officers on show of force to Lekki Toll Gate (Admiralty Plaza) Obalende, Ikoyi, Jakande Roundabout, and oda areas inside Eti Osa Lagos Island.

Na part of efforts to stop crime plus ginger di morale of im officers for di areas, Lagos State Police Command tok.

As of Saturday morning 13 February, 2021, some #OccupyLekkiTollGate protesters chop arrest as dem land di tollgate, contrary to di assurance wey Lagos Police Commissioner give say anyone dey free to protest,

Lekki Toll Gate Lagos Nigeria [EndSARS protest]

BBC

Debo Adedayo popularly [Mr Macaroni] wey be popular Nigerian comedian and oda Nigerians wey bin dey pass Lekki tollgate, venue of di planned protest chop arrest by police wey don mount heavy security since Friday night.

One of di pipo wey police arrest, Damilare Adenola tell BBC Pidgin say im bin come di tollgate to “observe wetin dey happun for di area.

Lekki Toll Gate today [#OccupyLekkiTollGate]

BBC
Police full ground for ‘Lekki Toll Gate Admiralty Plaza’ on Saturday morning 13 February, 2021

Meanwhile Lekki Concession Company [LCC] don beg Nigerians wey dey plan to protest go di Lekki Toll Gate inside Lagos tomorrow to reconsider dia decision.

Dis statement dey come afta some Nigerians wey dey vex wan carry protest go di toll gate tomorrow sake of di Lagos Judicial Panel latest decision to hand ova di toll gate back to LCC.

Di company say di Lekki Toll Gate Plaza don already dey destroy sake of di EndSARS protest wey happun October 20, 2020 and if Nigerians carry out anoda protest go dia again, e go bring sad memories plus cause more sadness to di families wey don already dey affected.

” We wish to use dis medium to appeal to well-meaning Nigerians from across di divide to reconsider di decision, wey get di potentials of repeating di disruptions we all don suffer and especially to bring sad memories to different families wey dey affected by di protest of October 2020.”

Lekki Toll Gate Lagos Nigeria [EndSARS protest]

BBC
BBC Pidgin find out say di policemen go tanda for Lekki Toll Gate Admiralty Plaza all night, in fact do wake-keeping for di area to secure di tollgate.

Tori be say groups dey plan to occupy Lekki Toll gate wit demonstrations wey go use hash tags like: [#OcuppyLekkitollgate] [#DefendLagos] and [#DemNoBornDemWell] to protest authorities decision to return di toll plaza back to di company wey dey operate am.

Lekki Toll Gate today protest update

BBC
Lekki Toll Gate today protest update: Nigeria [EndSARS] protest on February 13 Lagos and Abuja

Getty Images

Nigeria [EndSARS] protest on February 13 no be something wey Federal Government go tolerate.

Nigeria goment don cut serious warning give pipo wey dey plan to do fresh protest for Lagos to occupy di Lekki toll gate area for di state on Saturday February 13.

Dem say dem get intelligence informate say, some Nigerian activists don link up wit odas outside Nigeria, to destabilize di Kontri.

Getty Images

“We no go allow dis to happen”. Na wetin Lai Mohammed wey be minister for Information and Culture tok as im address di matter of di planned protest for Lagos wey be di commercial center for Nigeria.

Tori be say early dis week some pipo begin ginger for social media say dem go occupy di Lekki toll gate area afta di state judicial panel wey dey investigate di shooting incident wey happun dia for October last year give di company wey dey manage di place green light to take control of di gate.