Uganda Elections 2021 Results: Bobi Wine vs Yoweri Museveni – Electoral Commission tally centre results show Museveni in early lead but Robert Kyagulanyi declare imsef President-elect

Bobi Wine don reject di results of Uganda 14 January Presidential election and call himself di president-elect.

Bobi Wine wey be di opposition candidate wit real name as Robert Kyagulanyi say dis na di worst vote rigging in Uganda history.

Robert Kyagulanyi AKA Bobi Wine declare say di struggle just dey beginning. Im say im go address di press again in a few hours on di way forward.

Meanwhile military don surround Bobi Wine house.

[Uganda Elections 2021 Results] – 8:00 GMT 15/01/21 Update:

Uganda Elections 2021 Results: Yoweri Museveni in early lead

Reuters

Uganda Election results show Museveni in early lead

Di Ugandan Electoral Commission, EC national tally Centre continue to release provisional results of yesterday Presidential election.

Results from 23.9% of all polling stations, show say President Museveni get a sizeable early lead for over 65 percent of di votes wey dem don so far.

Di closest na Bobi Wine, di main opposition leader wey don gada 23 percent.

Museveni get 1,536,205 votes (65.02%), while his main rival Robert Kyagulanyi, popularly known as Bobi Wine score 647,146 votes (27.39%) from 8,310 polling stations.

Bobi Wine dey claim widespread fraud and violence during Thursday election but e no give details of him accusations.

Uganda Elections 2021 Results: Bobi Wine vs Yoweri Museveni

Reuters
Uganda goment say di elections dey peaceful

[Uganda Elections 2021 Results] – 7:00 GMT 15/01/21 Update:

Uganda Elections 2021 Results: Bobi Wine vs Yoweri Museveni

AFP
Di released first hand alias preliminary results on Friday from 330 polling stations show President Yoweri Museveni dey take early lead.

Uganda Electoral Commission broadcast results even wen internet dey blocked

Uganda’s Electoral Commission on Thursday ensure say di direct results of di Presidential and Parliamentary election wey dem dey tally for di main national polling station go continue despite di closure of di country’s internet.

Electoral Commission chief Simon Byabakama say dem dey were use some kain tactics to launch di results but e no gree provide further details.

” We no dey use di kontri internet to broadcast. We use our system. “Don’t worry, di results go dey broadcast despite di fact say internet network dey blocked,” Byabakama tok.

Di released first hand alias preliminary results on Friday from 330 polling stations show President Yoweri Museveni taking early leadership according to Uganda tori pipo Daily Monitor.

Uganda get a total of 34,684 polling stations,

Ugandan law empowers di Commission to receive results from all districts and to publish dem within 48 hours after di voting process dey completed.

[Uganda Elections 2021 Results] – 5:00 GMT 15/01/21 Update:

Uganda Elections 2021 Results: Bobi Wine vs Yoweri Museveni - 'Electoral Commission respect di voices of Uganda pipo'

BBC

Bobi Wine ask Electoral Commission to respect di voices of Uganda pipo

Pipo dey wonder how di Electoral Commission go tally yesterday presidential and parliamentary election results as internet dey blocked for di East African kontri.

Di electoral commission say dem go announce di results of di election within 48 hours afta voting end.

Presidential candidate Robert Kyagulanyi, popularly known as Bobi Wine don ask di Electoral Commission to respect di voices of di Ugandan pipo.

Bobi Wine say at di end of di day im expect to win and everi time Uganda suffer kasala na wen dem experience bad election.

Di main presidential opposition candidate, Bobi Wine, say dem arrest some of im polling agents.

Im dey challenge di current president, Yoweri Museveni wey don dey for power for nealy 35 years.

Oga Museveni say im go accept di result if e no get any irregularities.

Uchaguzi Uganda 2021:Bobi Wine ataka Tume ya uchaguzi kuheshimu sauti ya waganda
The British Broadcasting Corporation

[Uganda Decides] – 20:00 GMT 14/01/21 Update:

Uganda presidential election na ‘success’ – Electoral Commission chairman

Di chairman of Uganda electoral commission, Simon Mugenyi Byabakama, don hail di elections wey presidential and parliamentary candidates seriously contest as successful.

For di news conference wey dem do for di kontri capital Kampala, im say Uganda pipo comot for large number to vote peacefully even wit di challenge of coronavirus pandemic.

For morning, ballot boxes bin no come early to polling stations and biometric voter cerification machines bin fail. But Oga Bayabakama say dis na just few cases.

Di chairman of Uganda electoral commission, Simon Mugenyi Byabakama, don hail di elections wey presidential and parliamentary candidates seriously contest as successful.

Uganda Elections 2021 Results: Bobi Wine vs Yoweri Museveni

Reuters
Uganda Elections 2021 Results: Bobi Wine vs Yoweri Museveni

[Uganda Decides] – 19:00 GMT Update:

Police for Uganda capital Kampala don arrest 26 pipo from civil society groups on top accuse say dem allegedly set up illegal vote-counting centre for one hotel.

Tok tok pesin for di police Directorate of Criminal Investigation (CID), say dem catch dem wit materials wey show say dem dey compile results.

Im say none of di pipo wey dem arrest get accreditation to monitor elections.

Dem dey currently question dem for CID headquarters for Kampala.

[Uganda Decides] – 17:00 GMT Update:

Vote counting don begin for some polling stations for Uganda capital, Kampala.

In di last hour before voting close for 13:00 GMT, Security men wey full ground increase.

Lorries carry soldiers drive through di city, while police and local defence units bin dey also patrol.

For some areas, voting dey go on. Election regulations state say pipo wey dey for queue fit vote after di official closing time pass.

[Uganda Decides] – 15:00 GMT Update:

Uganda President Yoweri Museveni, 76, don vote less than 15 minutes before polling stations officially close, Uganda local tori pipo don tweet.

Polls officially close for 13:00 GMT, but pipo for queues go still dey allowed to vote.

Museveni, wey don dey power since 1986, dey seek sixth term for office.

Di president vote for Rushere town for western Uganda.

[Uganda Decides] – 12:00 GMT Update:

Voters, election observers lament delays on Ugandan presidential election day inside total internet shutdown.

Those wey tok wit BBC team for some parts of di capita Kampala say dem don tanda for polling centre since 6am local time [3:00 GMT] but up until 11am [9:00 GMT] dem still dey experience voting delays.

Ndugua Hassan, one local observer from Uganda Youth Coalition on Electoral Democracy say di process dey slow and frustrating especially for older pipo.

Some polling officers also complain of logistics challenge in organizing di election.

BBC Pidgin find out say some polling stations open late because ballot boxes take a long time to arrive and many biometric voter verification machines fail to work.

Polling stations go close at 1300GMT. Results fit dey declared within 48 hours from di close of voting.

[Uganda Decides] – 10:00 GMT Update:

Bobi Wine tell Ugandans “stay for polling stations guard your votes, dem block internet to keep di world in di dark”

https://www.facebook.com/bbcnewspidgin/posts/1725871104285275

Uganda Election Day 2021: Bobi Wine, wife Barbara Itungo Kyagulanyi

BBC

Bobi Wine tell BBC team for Uganda afta im cast im ballot say “Museveni block internet to keep di world in di dark about wetin dey happun” alias manipulate di election.

Right now na total shutdown of internet for Uganda based on government instruction. Access to internet only dey available via VPN or satellite.

Bobi Wine di music star turned politician wey real name na Robert Kyagulanyi Sentamu cast im vote around past nine dis morning as pipo of Uganda dey elect dia president today.

Uganda Election Day 2021: Robert Kyagulanyi Sentamu AKA Bobi Wine speak wit BBC

BBC
Uganda Election Day 2021: Robert Kyagulanyi Sentamu AKA Bobi Wine speak wit BBC shortly afta di music star turned politician cast im vote for Freedom Square Magere inside Kampala dis morning.

Di National Unity Platform- NUP candidate and im wife Barbara Itungo Kyagulanyi na im waka togeda go di polling station for Freedom Square Magere inside di Capital Kampala on Thursday morning.

Im be di main opposition candidate for Thursday presidential election.

Bobi Wine, just before di election open dis morning, tell pipo of Uganda say dia mind strong alias firm and nothing go stop dem from ending wetin im call ‘dis oppressive regime’.

Uganda Election Day 2021: Bobi Wine don vote for Ugandan presidential election day inside total internet shutdown

BBC
Bobi Wine wear face mask
Uganda Election Day 2021: Bobi Wine, IM WIFE don vote for Ugandan presidential election day inside total internet shutdown

BBC
Bobi Wine, wey real name na Robert Kyagulanyi Sentamu bedi main opposition candidate for Thursday presidential election.
Uganda Election Day 2021: Bobi Wine, wife Barbara Itungo Kyagulanyi

BBC
Uganda Election Day 2021: Bobi Wine, wife Barbara Itungo Kyagulanyi

BBC

[Uganda Decides] – 8:00 GMT Update:

Total internet shutdown for Uganda as voting begin on presidential election day

Uganda Election Day 2021:

BBC
Fotos from Uganda Election Day 2021 Thursday 14 January, 2021 as e dey happun

Voting don start for Uganda presidential and parliamentary election inside di East African nation.

President Yoweri Museveni 35-year long rule dey face challenge from music star turned politician, Robert Kyagulanyi AKA Bobi Wine afta a campaign season wey get violence, intimidation and anyhow arrests of opposition candidates and their sympathizers.

Uganda Election Day 2021: Voting for Ugandan presidential election day inside total internet shutdown

BBC
Fotos from Uganda Election Day 2021 Thursday 14 January, 2021 as e dey happun
Uganda Election Day 2021:

BBC
Fotos from Uganda Election Day 2021 Thursday 14 January, 2021 as e dey happun

[Uganda Decides] – 5:00 GMT Update:

Yoweri Museveni vs Robert Kyagulanyi AKA Bobi Wine presidential contest – poll open

Uganda elections 2021: Yoweri Museveni vs Bobi Wine Uganda Decides presidential contest

BBC

Ugandan presidential election open at 07:00 local time (04:00 GMT) today, but results no dey expected before Saturday.

Robert Kyagulanyi, known by his stage name Bobi Wine wey be 38-year-old pop star na di main challenger of Yoweri Museveni, 76, one of Africa longest serving leaders inside dis Uganda hotly contested election.

Bobi Wine, say im represents di kontri younger generation, while President Museveni say im dey stand for stability.

Di campaign for Ugandan presidential election na serious violence paint am, and e see dozens of pipo wey dem kill.

Uganda goment don order block on all social media. But social media users dey use di hashtag [#UgandaDecides2021] discuss di election across Africa.

Ugandan police say dem go send alias deploy officers on rooftops of di capital Kampala on election day, while armoured vehicles don begin patrol di streets.

President Museveni dey look for sixth elected term in office after 35 years in power.

Background [Ugandan presidential election]

Uganda election eve dey marked by heavy deployment of security forces mostly military to places wey dey considered hot-spots for violence.

Di BBC team inside Kampala say busy streets don empty wit a number of businesses wey don close shop and urban dwellers dey leave, in fact japa from di capital Kampala for fear of confrontations between opposition supporters and di security forces.

Uganda elections 2021: Yoweri Museveni vs Bobi Wine Uganda Decides presidential contest

Getty Images

Uganda pop star wey turn presidential candidate Robert Kyagulanyi AKA Bobi Wine cut im live interview with one Kenyan radio station say army don dey raid im house.

Dis dey come two days before Ugandans go vote for general election afta campaign wey bin get palava wey kill plenti pipo.

On Tuesday night, President Yoweri Museveni, for one TV national address say Uganda don block access to social media and messaging apps.

Museveni add say im no go allow foreigners to determine who dey good or who dey bad inside Uganda.

Observers from Africa but not from [US] America

Di US announced on Wednesday say dem dey withdraw dia election observers afta most of dia accreditation requests dey denied.


Meanwhile American ambassador for Uganda say she dey disappointed afta di goment reject many US election observers.

Ambassador Natalie Brown say dem deny more than 75 percent of di accreditation requests for US mission to monitor tomorrow Presidential and Parliamentary vote.

What you need to know about Uganda’s elections
The British Broadcasting Corporation

President Yoweri Museveni dey contest for im sixth term for office and dey face 10 challengers including Bobi Wine.

Human rights groups don dey accuse security forces of di kain force dem dey use to scata opposition rallies.

However, di goment say na to make sure say pipo follow di rules about large groups for dis coronavirus pandemic.

Uganda elections 2021: Yoweri Museveni vs Bobi Wine Uganda Decides presidential contest

Getty Images

How Ugandan presidential election 2021 dey important to Africa?

Uganda wey dey border with Kenya, South Sudan, Tanzania, Rwanda and di Democratic Republic of Congo get one of di highest refugee population for World with 1.4 million pipo.

So pipo don dey watch di political kasala for di kontri and dey worry aabout wetin go happun afta di vote.

Dem neva do peaceful transfer of power for di kontri before and should in case Museveni lose, e no clear wetin go happun.

Dis na as internation scrutiny to di election go dey reduced as di European Union no gree send observers for dis year election on top say Ugandan officials no gree listen to dia observers di last time to do free and fair elections.