Anthony Joshua vs Pulev: Tyson Fury, [how much did Anthony Joshua make] Prize money & fotos for AJ last fight

Anthony Joshua and Tyson Fury fight for 2021 discussion fit finish within a couple of days, Boxing Promoter Eddie Hearn tok.

Joshua knockout Kubrat Pulev on Saturday and dis don open road for di fight between di two British boxers.

Dem say negotiation go start on Monday and fit be di first fight for history for all four heavyweight titles.

“E no get any reason why we no go complete di deal and move on and solve di oda problems,” na so Hearn tok.

Tori be say many pipo dey tip WBC world heavyweight champion Fury installed as di favourite to beat IBF, WBA and WBO belt holder Joshua if dem fight next.

Anthony Joshua vs Pulev: [how much did Anthony Joshua make] and Tyson Fury record

Getty Images
Di discussion about Anthony Joshua and Tyson Fury fight for 2021 fit happun within a couple of days.

Dem ask Hearn how long di discussion go take to complete di deal, Hearn reply say: “A couple of days.

“We need to write to di governing bodies and say yes we get deal and we go now tok to di various sites and confirm di dates shortly for wetin I feel say suppose be di end of May.”

“I want di fight next. I no fit wait to knock am out,” Na so Fury tok for video wey im post on social media on Saturday night.

How much did Anthony Joshua make?

Anthony Joshua take home in di region of £10million after im comfortable win against Kubrat Pulev.

Meanwhile see fotos dem of how Joshua kpo- kpo Pulev

How di fight waka

Anthony Joshua vs Pulev: [how much did Anthony Joshua make] and Tyson Fury record

Getty Images
Anthony Joshua ring walk for IBF, WBA, WBO and IBO World Heavyweight Title Fight in front of 1000 fans for SSE Arena, Wembley
Anthony Joshua vs Pulev: [how much did Anthony Joshua make] and Tyson Fury record

Getty Images
Pulev chop better blow from Joshua wey bin dey lead on points before di knockout for round nine