Lagos gas explosion: See wetin we sabi about Ijora gas explosion wey dey hapun now-now

Ijora gas plant explosion

BBC

One gas tank catch fire for Ijora area of Lagos state on Wednesday afternoon and BBC Pidgin visit di site.

Di tok-tok pesin of di gas company wey e affect, OVH Energy Marketing Limited, confam to us say di fire don dey burn for ova one hour.

Oga Oyet Gogomery say dem neva fit confam wetin cause di fire but e tok say dem no get any causalities

From wetin we gada, di site na wia dem dey keep gas- dem call am tank farm and na industrial area of Lagos State.

Di officials of di Lagos State Emergency Management Agency don already reach di location to quench di fire

Ova five different fire truck na im dey on ground to cool di tank

No investigation don find out di root cause.

We go dey give una more update….