Travel visa: [Visa free countries] Nigerians fit travel to Barbados, Georgia, without IELTS – See oda places here

Travel visa: [Visa free countries] Nigerians fit travel to

State House/Getty
Nigeria International Passport dey ranked as di number 95th for di world while Japan dey number one and pipo wit Japanese passport fit travel to 191 kontris witout visa [visa-free].

Nigerians fit travel to just 47 kontris witout visas alias visa-free or get visa on arrival.

“Canada, visa, passport, japa, it is finished” and oda words wey get to do wit travelling na im trend for Nigeria shortly afta President Muhammadu Buhari speech on #EndSARS protest.Some Nigerians for social media begin post about leaving di kontri sake of say dem no dey happy wit wetin di president tok during im 12 minutes broadcast by 7pm Thursday 22 October.

While some dey complain say e no address di Lekki toll gate shooting of unarmed #EndSARS protesters, odas dey para say e no care about im citizens, na dia yans about leaving di kontri begin spread.

So BBC Pidgin do research on kontris wey Nigerians fit travel to without visa.

See visa-free kontris wey Nigerians fit travel to:

  • Bangladesh ( Visa on arrival)
  • Barbados (visa free for six months)
  • Benin republic (Visa free)
  • Burkina Faso (Visa free)
  • Burundi (Visa on arrival for 30 days)
  • Cameroon (Visa Free)
  • Cape Verde (Visa on arrival)
  • Chad (Visa Free)
  • Camoros Island (Visa on arrival)
  • Cote d’ivoire (Visa Free)
  • Djibouti (Visa on Arrival)
  • Dominican (Visa free for 21 days)
  • Fiji Island (Visa free for 21 days)
  • Gambia (Visa free 90 days)
  • Georgia ( Visa on arrival)
  • Ghana (visa free)
  • Guinea ( visa free)
  • Guinea Bissau (visa free for 90 days)
  • Haiti (visa free for 90 days)
  • Iran ( visa on arrival)
  • Kenya (visa free for 90 days)
  • Liberia (Visa free)
  • Madagascar (Visa free for 90 days)
  • Maldives (visa free for 30 days)
  • Mali (Visa free)
  • Mauritania (Visa on arrival)
  • Mauritius (visa free for 90 days)
  • Micronesia ((visa free for 30 days)
  • Mozambique (visa free for 30 days)
  • Nauru (Visa on arrival)
  • Niger ( Visa free)
  • Palau (visa free for 30 days)
  • Samoa (visa free for 60 days)
  • Senegal (Visa free)
  • Seychelles (visa free for 3 0 days)
  • Sierra leone (Visa free)
  • Somalia (Visa on arrival)
  • Sri Lanka (Electronic travel authorization)
  • Tanzania (visa on arrival)
  • Timor-Leste (visa free for 30 days)
  • Togo (Visa free)
  • Tuvalu (visa free for 30 days)
  • Uganda (Visa on arrival)
  • Vanuatu (visa free for 30 days)