Cameroon phone tax: Weti go happen if you get two SIM cards plus oda tins to know

Cameroonians from today, October 15, go start pay 33 percent as phone tax if de importers no pay before as e dey for 2019 finance law.

Kontri pipo vex say make goment stop de tax as na instead de user go get problem.

But, goment nova change e mind as deh say na for get custom duty weh importers no di pay, di make dem loss moni.

Custom officials say na only Fcfa 100million ($178600) di collect now; from Fcfa 2 billion ($3572018) per year for 2000.

Also, say deh only komot de tax from de custom check points bring’ am, online, for phones.

Na for October 15, any pesin weh e buy phone, tablet or electronics weh e no pay custom duty go get signal for e phone for pay tax.

Kontri pipo di vex why na customer go pay phone tax, some wan know how deh fit identify phone weh e no pay custom duty and de one weh deh no clear am before e buy.

Weti go happen if you get two phones

If you get two SIM cards, for one phone, de message for de amount of tax weh pesin get for pay di go na for de main Sim Card.

But de problem na say if de pesin change position for de two SIM cards, e go receive new message for pay tax.

Since na phone goment di tax, pesin weh e get laik four phones go pay tax for all de phones.

Telephone wit same IMEI (International Mobile Equipment Identity) – identity number

De platform for tax get system weh deh go add SIM card, de owner e name and IP address for make sure say na de real pesin e telephone. Customs don try for make sure say deh give particular account for any telephone number.

Foreigners dia telephone

If pesin travel enta Cameroon, di use e phone weh e kam wit’am, no problem.

But, if e wan use local SIM card for e phone, e get for signal customs as e di enta, den e go pay only for de taim weh e spend for Cameroon.

How you fit identity phone weh customers nova clear

For identify phone weh customs nova clear, pesin weh e di buy go first get for put SIM card inside de phone.

If message komot wit de amount of tax, and say make e chose how e go pay e 30 percent tax den, e mean say de pesin weh e import de phone no pay custom duty.

But if message no komot, den e mean say deh clear de phone; sabi pesin for information technology explain.

How for know phone wit custom clearance

All importers of phone get for take responsibility, for tell pesin weh e di buy phone say e don pay de tax or not. If not, de buyer get for put e SIM card and if e get message e mean say de phone no pay tax.

De importer get for sell for low price since de customer go pay de tax.

See de different amount weh different telephones get for pay

Simple phone, for only call and receive, send message, de tax na from Fcfa 3000, ($5,36) to Fcfa 10000, ($18).

Wusai customer fit send complain

Customs officials say deh go komot free number for call afta.

Lowest category for smart phone

Phones weh e fit call, take picture and video, get touch screen, di connect for internet, dia tax start from Fcfa 15:000: ($27) reach Fcfa 25:000 ($45).

High class smart phones and tablet,

Phones weh deh bi laik pocket computers, wit applications, and plenti functions, download applications, WiFi…

Dia tax bi from Fcfa 25;000, ($45) go reach Fcfa 200,000, ($357).

How de payment go work

Wen pesin put e SIM card for new phone from any provider, e go pick IMEI (number weh e di identify dem) for de phone, send message wit how much de owner di owe. Deh di calculate 30 percent of how much de phone cost send’am inside message den de pesin go decide if e wan pay one taim or for small-small.

If you get airtime weh e reach de amount and you want pay one taim, den deh cut ‘am. If not any taim weh de customer put airtime deh go cut’am until e finish.

Dis mean say any taim de pesin put airtime, deh go cut’am until de tax finish.

But if business pipo pay de tax, den de customer no go pay tax, but kontri pipo di fear say price for phone go increase.

Anoda tin weh customers get for know na say deh di cut fcfa 200 from airtime any de pesin download application.

De law say any visitor weh e di use e phone for roaming and pipo weh deh already get dia phones no go pay de tax.

Na since last year 2019 weh goment komot de tax, Minette Libom Li Likeng, post and telecommunications minister try for explain for pipo for tweeter say goment nova increase phone tax.

For yi, de only tin weh e change na say de komot de tax from custom office put’am online and na for reduce fraud and catch pipo weh deh no di pay tax.

Kontri pipo as deh di show dia vex for social media wit #EndPhoneTax and #EndPhoneTaxBrutally.