Happy Independence Day Nigeria “October 1st protest” pictures as police arrest #RevolutionNow organizers

"October 1st protest"

BBC

Many protesters on Thursday bounce enta streets of Lagos, Nigeria first political capital to express their displeasure against bad governance on di same day di kontri dey celebrate Independence Day

But police no waste time arrest organizers of di protest, wey be Revolution Now group.

BBC Pidgin find out say hours afta di protest start, Nigerian police officers wey use barton smash journalist head during of di revolution now protest for Lagos.

Tori be say as di protest dey go on peacefully, various teams of police men arrive di Maryland venue and begin do negotiations wit di protesters. As di protesters finish dia waka begin clear di location, anoda team of police me arrive di scene begin arrest di remaining protesters and harass journalists.One of di police officers use barton hit Punch newspaper cameraman Jayiola Kayode for head and e fall for ground blood begin rush out.

"October 1st protest" pictures as police arrest #RevolutionNow organizers

BBC
Lagos police Oga Hakeem Odumosu frown for di action of di police officer wey attack di journalist.
"October 1st protest"

BBC

Lagos State Commissioner of Police, CP Hakeem Odumosu say dem don cari di journalist go hospital to treat am say dem go dey responsible for im treatment

Di protesters wey dey shout alias chant songs of solidarity march from di streets of Ojota to Maryland in Lagos.

Similar protests happun for Abuja and oda towns for Nigeria and na activist and journalist wey bin contest 2019 Nigeria presidential election Omoyele Sowore na im organize di protests to demand for decrease of petrol pump price, electricity tariff and demand for good governance.

Earlier, Nigeria President Muhammadu Buhari during im ‘Nigeria At 60’ speech tok say: “E no make sense for oil to be cheaper in Nigeria pass in Saudi Arabia.”

"October 1st protest" pictures as police arrest #RevolutionNow organizers

BBC

Abuja protest:

Members of di #RevolutionNow group use dia protest to demand say make president Muhammadu Buhari resign from power.

Di convener of di movement Omoyele Sowore tok dis wan wen e lead protest to di US embassy for di capital Abuja.

E explain give say since Buhari enta power, insecurity, hunger and corruption for di kontri don too much and na di ordinary pipo dey face di hardship.

But President Buhari say di 60th anniversary of Nigeria independence, wey fall on di same day of dis protest, na opportunity for Nigeria to begin sincere process of national healing.

Make pipo put an end to di old ways dem dey do things. Make dem no dey reason say I come from dis part of di kontri but make dem see themselves as one Nigeria. Buhari add.

He say to start dis healing process, citizens must recognize themselves as one pipo.

Di protesters bin no fit gathera for di usual Abuja Unity Fountain sake of say police and oda security agent take over di place.

But dat one no stop dem as di protest enta road to march to U.S embassy wit dia placards wey cari write up alias inscription like: ‘Buhari don fail’ ‘Failed leadership n aim make Nigeria capital of di world’.

And dem also dey sing solidarity song to show how goment don fail di pipo for Naija.

Di protesters also want both di US and UK goment don place visa ban on di Director General of DSS (Department of State Service) wey be Nigeria secret police, sake of how DSS men descend on protesters for Osogbo town for south west Nigeria.

Di Protesters also say Nigerians no dey happy wit di kontri economic condition and dat as e be now, di kontri no dey work.

Adebayo Rapheal wey also join di protest say Nigerians don pass vote of no confidence for di kontri political leadership and dat under oga Buhari, di economy don dabaru.

Aisha Yesufu wey be one of di convener of Bring Back Our girls say Nigerians gatz make di kontri work again sake of say tin don spoil finish.

While Deji Adeyanju say e dey bad as goment dey try close di mouth of protesters for di kontri.

"October 1st protest"

BBC

Nigeria gain independence from Britain on 1 October 1960. Seven years later, one civil war happun, di south-eastern region wan breakaway to form Biafra state.Millions of people na im dem believe say die before di war end 1970.Tension continue to dey between di north and south and competitions between ethnic groups.

"October 1st protest"

BBC

How social media dey react to Independence Day Nigeria

Many Nigerians also take to social media to share dia joy, pain, frustrations, hope and how they feel about di kontri.

#Nigeria60AndUseless, #NaijaLikeNeverBefore, #NigeriaAt60 #IndependenceDay, #60Together trend for social media on independence day