Moctar Ouane biographie: President Bah Ndaw name Mali new Prime minister, see Moctar Ouane profile

Mali President name new Prime Minister

AFP

Mali leader for di meantime alias transitional President don name a new civilian prime minister

President Bah Ndaw appoint former diplomat Moctar Ouane as di new prime minister, according to state television announcement on Sunday.

Oga Ouane bin serve serve as Mali foreign minister between 2004 and 2011 during Amadou Toumani Toure’s presidency.

Im bin serve as Mali permanent representative to di UN from 1995 to 2002 and later become diplomatic adviser to di west African regional bloc, Ecowas.

64 years old Ouane bin serv as peace and security representative for di West African Monetary Union (WAMU) since 2016.

Moctar Ouane na originally from Bidi in central Mali, di region most affected by armed groups’ attacks and inter-ethnic violence wey don give di kontri palava for years.

Di coup leader Col Assimi Goita bin pick Mr Ndaw – wey dem inaugurate on Friday – to be di transitional president.

Di appointment of a civilian president na one condition for Ecowas to lift di sanctions dm mpose after di coup.

Ecowas officials bin on Friday say dem go only lift di embargo afta dem also appoint a civilian prime minister.