Laycon, Trickytee, Ozo and Dorathy dey up for eviction dis week for di Big brother Naija season 5 lockdown edition.
Dis nomination dey come afta Big Brother change di twist of di game, divide di housemates into two groups and ask dem to publicly nominate who dem go like to evict from di house.
- How gunmen kidnap 17 members of one family in one single day
- Pastor Chris Oyakhilome breakdown of wen ‘rapture’ fit happun dey make pipo tok
- Nengi na BBNaija Head of House for di second time
- See di BBNaija housemate Lucy prophesy to win Season 5 lockdown show
How di Nomination process take waka dis week
Biggie divide di housemates into two groups of three housemates each, Black team and White team.
Big Brother give each team time to discuss and nominate two pipo from di oda group for eviction.
Ozo, Neo and Dorathy nominate – Laycon and Trickytee for eviction.
- I bin no support Kiddwaya to go for BBNaija – Terry Waya
- See Erica journey and big moments inside Big Brother lockdown season 5 house
While, Laycon, TrickyTee and Vee choose – Ozo and Dorathy as housemates wey dem go like see comot from di house.
Big Brother later announce di four housemates wey go fit leave di Big Brother Naija lockdown edition dis Sunday.
At least one of dem go leave di Big Brother house on Sunday during di live eviction show. As tins be Nengi, Vee and Neo dey save till di last day.
As tins be Nengi, Vee and Neo dey save till di last day.
Dis wan na afta Nengi win di head of house game housemates dey play every Monday to win immunity.
Dis wan mean say she get to stay for the show till di last day and get opportunity to become di winner of di BBNaija lockdown edition.
https://www.facebook.com/watch/?v=742114776363257&extid=vb1sT36I0xvBR274
Dis wan dey come afta Prince and Kiddwaya chop eviction comot from di lockdown house on Sunday, wen dem get di lowest votes among di housemates wey bin dey up for eviction dat week.