Gana: Benue ‘Most Wanted’ Terwase Akwaza don die – See how military take catch and kill am

Di Nigeria Army don confirm di death of one ogbonge criminal, Terwase Akwaza, alias “Gana,” for Benue state-north central Nigeria.

Di Commander, 4 Special Forces Command, Doma, Nasarawa state, Maj. -Gen. Moundhey Ali, na im break di news give tori pipo on Tuesday.

Di commander say dem kill Gana for near road roadblock wey army mount for along Gbese-Gboko-Makurdi afta dem exchange gunfire.

Wetin Really Happun

Gana di most wanted criminal and im gang dem bin dey go Makurdi to formalise dia second Amnesty programme wit di state goment.

Di Benue state goment bin declare second amnesty and call on jaguda boys dem for sankera geo-political region of di state make dem surrender dia weapon.

For 2015, di state goment grant 500 pipo amnesty and Gana dey among dem but e later go back begin commit crime, kill-kill pipo including according to authorities, Govnor Samuel Ortom special assistant security, Denen Igbana.

Goment den for 2017 declare am wanted and police place 10 million naira bounty on top im head.

But dis time around, some elders from Sankera area wey include Ukum, Logo, Katsina Ala local goment bin travel to Katsina Ala local goment to go welcome di repentant criminals.

Dem hold ceremony for di Katsina Ala township stadium wia Gana and im gang surrender dia arms and afta dat, dem come drive dem to Makurdi di state capital to formalise di process.

But on dia way, military pipo dem wey don dey look for Gana tey tey come wey lay dem.

Di army commander say na around 12:00 hours on Tuesday, na im dem receive strategic information on top di movement of Terwase Akwaza Agbadu AKA Gana along Gbese-Gboko-Makurdi road.

Di Troops of Operation ‘Ayem Akpatuma III’ come move sharp sharp, mount roadblocks for road.

For around 13:00 hours, dem come begin exchange guns wit Gana convoy and na so dem take kill am.

Oga Ali say dem also capture 40 armed members of Gana boys dem and dem dey for army custody pending wen dem go carry dem go court.

E also yan give say dem recover several rifles, pump-action guns, ammunition, charms, and explosives and dat dem don deposit Gana corpse for one hospital.

‘Deadly criminal’

Gana and im boys dem be one deadly criminal gang wey dey operate around Sankera area wey include Ukum, Logo, and Katsina Ala local goment of Benue state.

Dem even spread dia evil deed enta Taraba state.

Dem dey cari out high profile robbery and kidnap pipo for ransom and even kill pipo.

Im and im gang also bin kill di special assistant to govnor Ortom on security according to authorities and sake of dis and oda crimes, security agencies don dey look for am tey-tey.

For several years, security pipo try to catch am but no way until yesterday wey dem kill am.

Benue pipo reaction

Meanwhile some Benue pipo don di react to di way and manner wey di army take kill Gana and im boys dem.

Many of dem wey speak wit BBC pidgin say even though e be criminal, dem for no way-lay am for road and kill am, afta e don surrender to goment second amnesty programme

Dem say dem dey fear say some of im men wey escape go fit begin take revenge on di pipo of di area.