NDA application portal shortlisted candidates 2020 requirement for Nigerian Defence Academy 72 Regular Course selection board

NDA – Nigeria Defence Academy application portal don release shortlisted candidates for di 2020 72 Regular Course selection board wey go happun.

Di two thousand nine hundred and forty young men and women wey di Nigeria Defence Academy shortlist for di go show for di Armed Forces Selection Board interview from Saturday September 12 to October 10 2020.

According to informate wey di Academy post for im website, dis na tins wey you need to know plus tins wey you need to cari follow bodi if your name dey di list.

Check your name

First tin you need to know na weda your name or di name of you friend or family member dey di shortlist.

To check names you fit go di Nigeria Defence Academy website.

Dates for di interview and venue

Venue for all di interviews na di old site of di Nigeria Defence Academy, Ribadu campus, Kaduna.

Di interviews go happun in three batches inside three Saturdays.

Di Academy don tear warning give all di candidates say, if you show for NDA premises on di day wey no be your day and dem actch you, dem go “disqualify you.”

NDA application

Getty Images
Nigeria army dey parade

Batch 1

September 12 na for candidates wey dey batch 1.

Dis batch na for candidates from Anambra, Bauchi, Delta, Edo, Ekiti, Enugu, Gombe, Kano, Kaduna, Nassarawa, Ondo and Plateau states.

Batch 2

Candidates for second batch must to show on September 26.

States for dis batch include, Abia, Adamawa, Akwa Ibom, Benue, Imo, Katsina, Kogi, Osun, Oyo, Rivers, Yobe and Zamfara States.

Batch 3

If you from any of dis states, Bayelsa, Borno, Cross River, Ebonyi, FCT, Jigawa, Kebbi, Kwara, Lagos, Niger, Ogun, Sokoto and Taraba States, den your own go happun on October 10.

Document you suppose cari

A – JAMB UTME result slip 2020

B – Acknowledgement form and NDA screening test admission card

C – Academic certificates / statements of result and testimonials for primary and secondary schools (junior and senior)

D – Birth certificate or declaration of age, (dem prefer birth certificate

E – Letter to prove say you come from your state or local goment indigeneship wey SSG or chairman of your local goment sign, or certification wey military officer from your state of origin sign – di officer must be from di rank of Lieutenant Colonel go up or im equivalent for Nigerian Navy and Nigerian Air Force.

You fit use di letter from di officer in place of local goment indigeneship certificate. In dis case, di officer must to add im formation/unit, appointment, contact address,fone numbers plus e-mail address. Di officer must also add im formation/unit stamp den sign.

F – Letter of consent or permission from your parent or guardian.

NDA application

Getty Images
Recruits dey train for Depot of Nigeria Army for Zaria

Oda tins you must to cari follow bodi

•Writing materials

•Three blue knicker and 3 white (round-neck) T-shirts

•One white canvas shoes and 3 pairs of white socks

•Toiletries

•Non-refundable fee of N2, 500.00 each for verification/confirmation of results at WAEC/NECO

•Scratch cards for WAEC and/or NECO results for online confirmation of result

•Four recent coloured passport foto

•Di second copy of Postcard foto wey you bin present, wey NFA stamp for di exam centre during di screening test

•No forget to cari your transport moni to and from Kaduna

•remember to also cari face shield and individual face mask