BBNaija: Prince , Erica and Neo clash with Lucy- See wetin cause dia quarrel

Kasala gas today for inside Big Brother season 5 lockdown house as di Head of House, Erica, her deputy, Prince and Neo clash with Lucy on top team selection.

Di housemates para afta Lucy no wan gree accept to join di team wey di HOH and deputy put her sake of say Kiddwaya and Erica dey dat team.

Erica wey be di Head of house tell Lucy say: “You get bad attitude, You be di problem for every team.”

Then Leo begin tell di housemates to clear Lucy and make her corporate instead of her to dey reject di group wey dem put her.

“Una no wan follow am talk, una dey condone rubbish.” dis na wetin Neo tok.

Di argument come serious sotey Prince wey be Deputy Head of House para and begin shout

“I don dey tell you dis thing ever since you waka enta do house, ever since we dey here. I be your friend, I go try to tell you wetin dey right for you. But then I no go keep quiet for your nasty attitude” Prince tok.

Lucy come dey ask prince wetin she do now? wetin she don do different dis time and dis na wetin Prince tell her;

“If you get attitude problem, make you keep am to yourself, we dey try to work on something…wetin you do different be say, you dey try to disobey di rules concerning Di task wey dem give us .

“Dem tell us to share ourselves into groups and di head of house and deputy decide to to do sharing but you decide to make your own problem our own problem.”

How fans react to di quarrel

Fans of di reality TV show dey clash sef with each oda concerning weda Lucy dey right or wrong.