Femi Fani-Kayode: ‘No be di NDDC wey I serve proudly wey Obasanjo set up be dis’

Nigeria Former Minister of Aviation, Femi Fani -Kayode, don tok say di Niger Delta Development commission of today no be one wey di Olusegun Obasanjo goment set up.

Chief Femi Fani Kayode tok dis one during di live interview wey im do with BBC pidgin on Monday.

“Na pity say NDDC don get to dis stage, I mean di NDDC of today no be di NDDC wey di administration wey I serve proudly, wey di Obasanjo administration set up.” e tok

“Dis no be wetin we hope for NDDC. Dem bin set up di NDDC primarily to help di Niger Delta area and di goment plus pipo of dat area for dem to benefit from di money wey dey come from oil wey be dia resources.”

Nigeria house of representatives Committee on Nigeria Delta Development Commission bin start one public hearing dis year to investigates alleged financial misappropriation inside di agency.

Oga Kayode say im remember wen pipo like Timi Alaibe dey run NDDC and no complain but for di last few years, things don fall apart for NDDC.

“NDDC today na shadows of im former self and clearly issues dey grounds. Allegations dey fly upandan.”

Watch di full interview here:

https://www.facebook.com/watch/?v=802716727143475&extid=3zmO30JeQJFwvAa2

E say im believe say a lot of questions concerning wetin dey go on for Niger Delta Development commission need answers but im no go pass judgement on anybody.

Concerning di viral incident wey happun for Calabar, Cross River state during one press conference wia Fani-Kayode call journalist “stupid”, Fani Kayode explain say di journalist no ask any question but just tok say; “well, we no know who dey bankroll you.”

E say im lost im cool but accept say im reaction to di journalist dey wrong and e don apologize.

On why e dey do di tour to monitor projects across states now, Fani-Kayode say to wait till election time no go make sense. E say di tour na fact-finding tour for am personally.

“I feel like say e go dey good to inspire Nigerians, by sharing di truth with dem, not just talking about dem, but taking cameras dia for pipo to see for demsef wetin dey go on dia.”

“Na about unity, building bridges, 80% of di time no be about infrastructure inspection but na about discussion about di way forward for us as a party for 2020. I dey tok to some stakeholders, I be leader for PDP and I be one of di stakeholders and we believe say e dey important for us to get am right, unity for di party, bring us togeda and eventually select a good candidate, and support am to make sure say dia is a change in goment.” Fani -Kayode tok.