Victor Lindelöf: Swedish footballer & Manchester United defender receive thank you from police afta e catch handbag tiff

Victor Lindelöf

Getty Images
Victor Lindelof joined Manchester United from Benfica in 2017 for £31m

Manchester United defender Victor Lindelöf don turn hero afta e catch one tiff wey bin rob one old woman on Monday.

Di gbege happun for Lindelöf home town Vasteras, wey dey for Sweden capital Stockholm.

One police statement say one man for im 30s wey dey ride ontop bike, snatch bag wey belong to one woman for her 90s.

Tori be say Lindelöf “run afta di suspect”, catch am, and hold am till police reach.

For statement, Sweden police say dem wan use di “opportunity to thank di witness for im quick and wise action wey return di plaintiff property”.

Wetin Lindelöf do sweet di woman wey dem thief her bag so tey she offer to buy di 26-year-old Sweden international food as way to say thank you for im help.

Dem arrest di suspect for aggravated theft and minor drug offence.