Messi release clause 2020 from Barcelona – Dis na wetin we know

Lionel Messi

Getty Images

Six-time Ballon d’Or winner and Ogbonge Barcelona player Lionel Messi don tell di club say im wan leave dis summer.

Messi wey be 33 years old send di club fax on Tuesday to say im wan use di part for im contract wey go allow to leave free of charge with immediate effect.

Dis dey come afta Barca chop 8-2 beating from Bayern Munich for di Champions League quarter- finals for August 16.

Di Argentine player first play for Barca for 2004 and e don win Champions League four times.

Di board go meet soon and some pipo feel say di only thing wey fit calm am down na if dia president Josep Maria Bartomeu resign and dem do early elections. But Messi dey determined to leave di club no matter what.

Wetin be Messi release clause for Barcelona?

Messi bin sign new contract extension for 2017 wey go keep am for Camp Nou through di 2020-21 season—and make am di world highest-earning football but dem add one new exit clause. E go allow am to leave for free dis summer as long as im tell dem of im decision before June 10, 2020.

Barcelona believe say dat part of di contract no old water again and Messi still dey under contract wit di club until 2021 with 700m euro buy-out clause.

Messi di record breaker

Messi join Barcelona at di age of 13 from Newell Old Boys for Argentina for 2000, and im don score 634 goals wey be club for 731 appearances. Im don win 34 major trophies wit di club, including 10 La Liga titles and four Champions League trophies.

Dis na some records wey Messi hold:

  • Most goals scored for La Liga (444)
  • Most Ballons d’Or in history and most Fifa World Player of the Year/Best Fifa Men’s Player Awards (6)
  • Top goalscorer for all club competitions for a calendar year: 79 goals for 2012
  • Only player to score more than 40 goals for 10 consecutive seasons
  • Most goals scored for one single club for Champions League (115)