
Mamman Daura whereabouts na big kwesion wey some Nigerians don dey demand ansas for.
Daura, President Muhammadu Buhari powerful nephew, whereabouts concern na afta tori begin fly upandan say dem don fly am go abroad for urgent medical care.
Some news outlet for Nigeria bin carry report say dem don fly Mamman Daura go United Kingdom for urgent medical treatment on Wednesday.
BBC pidgin dey able to speak with three different sources from Mamman Daura immediate family to find out weda dis report na true plus know where oga Daura presently dey. Dis na wetin dem tok;
- E travel go UK with im wife, im daughter and son on Wednesday morning
- All of dem travel with one private jet
- Oga Mamman Daura dey kampe (hale and hearty) and e no dey suffer from any sickness
- E attend di burial of former spokesman of Buhari Wada Maida on Tuesday
- Im family bin want make e travel for long, but e insist say e no dey go anywhere because of di lockdown
All di three sources wey BBC tok with no want make dey mention dia names but all di information wey dem give na di same and one na pikin of Mamman Daura.
- ‘My papa no be ring leader of any cabal for Aso Villa’
- Wetin Mamman Daura, Buhari nephew tok for Interview wit BBC wey dey cause serious gbas-gbos
Who be Mamman Daura?
Mamman Daura na di son of President Buhari older brother and also e padi padi.
According to di book wey one American professor, John Paden write, e say na Mamman Daura encourage President Buhari to take im studies seriously.
Di book wey im tittle ‘Muhammadu Buhari: The Challenges of Leadership in Nigeria.’ also tok say e don tey wey oga Daura and di president dey do tins togeda.
Daura na one of di oldest journalists wey don dey around and e bin become editor of di New Nigerian newspaper few months afta e complete im graduate degree.
Na some months afta im finish from Trinity College wey dey Dublin, dem appoint am as editor of New Nigerian Newspapers and na late Adamu Ciroma bin employ ama. Im also serve as managing director for di company.
Afta di coup for 1983, Buhari become military Head of State and Mamman Daura get leg for di goment. Many tori wey comot say im dey influential for di time wey Buhari first be head of state.
E don bi work for Africa International Bank and open one factory wey dey make furniture for Kaduna. He was also a former chairman of the now defunct Nigerian Bank of Commerce and Industry.
Mamman Daura finish im secondary education for Okene Provincial School in 1956.
Im work wit Daura Native Authority for a couple of years before joining the Nigerian Broadcasting Corporation as a programme assistant.
From 1962 to 1968, im studied economics and public administration at Trinity College, Dublin.
As ogboge journalist im be, im focus dat time na on coverage of issues affecting Northerners and protection of northern interests.