Dapo Williams: Five things you need to know about di prominent Nigerian wey die for UK

Nigeria President Muhammadu Buhari and od ogbonge kontri pipo don mourn Dapo Williams, one popular Nigerian wey die for United Kingdom where im dey live.

In President Buhari message, di president describe Williams as man wey dey “passionate about we kontri”.

Abike Dabiri-Erewa, chairman of Nigerians in Diaspora Commission, tok say Williams death “shock” am.

According to website wey dem create for pipo to write condolence message for di man, Williams die on August 8, 2020. Dem born am for March 11, 1960.

Who be Dapo William?

  • According to reports from local tori pipo, di man na leader and pioneer of Nigerian Think Tank Group (NTTG), and bi member of the All Progressives Congress (APC) and Buhari Campaign Organization, for UK.
  • He also be member of Institute of Directors, London and Kent am dim get plenty Masters degree with one Ph.D from University of Salford.
  • He collect certificates from plenty ogbonge universities for di world, including Harvard Business School and University of Cambridge.
  • For im LinkedIn profile, im describe imsef as “commercially focused Corporate Real Estate/ Property FM strategist wey get over 30 years of experience for Building Maintenance industry”.
  • He also tok for di page say im don work for company wey dey do “Oil and Gas (on/off-shore) Subsea Install Base & Dehydration location; Computer-Aided Architectural Drawing for crude oil pipeline operations and maintenance”.